Liverpool dey top di Premier League afta dem win Crystal Palace

Crystal Palace 1-2 Liverpool

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mohamed Salah celebrate afta im score im 200th Liverpool goal
Published

Mohamed Salah score im 200th Liverpool goal as Jurgen Klopp side come from behind against 10-man Crystal Palace to move top of di Premier League and increase di pressure on dia former boss Roy Hodgson.

Salah na di fifth player to reach dis landmark for di club, im join di likes of Ian Rush, Roger Hunt, Gordon Hodgson and Billy Liddell, wen im score di equaliser for di 76th-minute.

Na Harvey Elliott wey deliver di decisive moment inside 10 minutes of added time, wit ogbonge strike from di edge of di penalty area to lift Liverpool above Arsenal.

Salah goal come 98 seconds afta Jordan Ayew chop red card.

Palace supporters bin boo dem off di field afta dia disappointing home loss to Bournemouth on Wednesday.

But tins bin dey go well for di hosts wit dia surprise lead from Jean-Philippe Mateta penalty.

Even though Liverpool bin get upper hand for di game, dem struggle throughout to break di hosts down and Alisson wey just dey return to di team help save for first half wen im push Jefferson Lerma first-time shot go post.

Di result mean say di Reds dey one point above last season runners-up Arsenal, wey go travel to third-place Aston Villa later on Saturday (17:30 GMT).

Checkout di match highlights inside hia.

Crystal Palace vs Liverpool

Wia dis foto come from, Getty Images

Second Half

FULL TIME 1-2

90+10 Mins- Luis Diaz don yellow card for bad tackle on Crystal Palace player.

90+9 Mins- Joe Gomez don collect yellow card.

90+9 Mins- Joachim Andersen don collect yellow-card.

90+10 Mins- Luis Diaz don yellow card for bad tackle on Crystal Palace player.

90+9 Mins- Joe Gomez don collect yellow card.

90+9 Mins- Joachim Andersen don collect yellow-card.

90+6 Mins- David Ozoh don enta im replace Will Hughes.

90+6 Mins- NO GOAL afta VAR review show say na offside!

90+4 Mins- Gooal! No wait, no na offside. Luis Diaz no gree, but di linesman dey sure about im decision.

90+1 Mins- 1 - 2

Goal! Mohamed Salah pass find Harvey Elliott for di edge of the box and im fire di ball inside di net. 1:2.

90 Mins- Di fourth official show 10 min. of added time.

88 Mins- Harvey Elliott na di first to get di ball but di ball go ova di bar.

88 Mins- Remi Matthews block Joe Gomez pass.

87 Mins- Sam Johnstone don comot sake of injury. Roy Hodgson bring in Remi Matthews.

84 Mins- Sam Johnstone dey down injured, di referee don stop play so im fit receive medical treatment.

84 Mins- Substitution. Jeffrey Schlupp don comot and Naouirou Ahamada don enta field.

83 Mins- Konstantinos Tsimikas cross di ball inside di box from corner but defence clear di ball

80 Mins- Joe Gomez play nice cross, but Sam Johnstone punch di ball away.

78 Mins- Good clearance from Liverpool defence na Crystal Palace corner.

78 Mins- Referee Andy Madley don pause di game to tok to Roy Hodgson, e give am yellow card.

77 Mins- 1 - 1

Goal! Mohamed Salah don equalise.

75 Mins- Jordan Ayew dey trouble. Im commit anoda bad foul, and now don chop red card

74 Mins- Jurgen Klopp decides to make substitution. Harvey Elliott dey replace Darwin Nunez.

74 Mins- Substitution for Liverpool Curtis Jones don enta for Dominik Szoboszlai.

71 Mins- Andy Madley don show Chris Richards yellow card for foul.

70 Mins- Virgil van Dijk win di ball from di corner but im no fit direct on target

70 Mins- Trent Alexander-Arnold cross di ball inside Crystal Palace box

67 Mins- Problems for Roy Hodgson as Jefferson Lerma no go fit play again. Im injury dey serious dem don comot am put Michael Olise.

66 Mins- Referee don pause game oh, Jefferson Lerma get injury.

64 Mins- Jefferson Lerma don collect card afta im bring down im opponent.

62 Mins- Jeffrey Schlupp waya hot short but im low effort end up for di goalkeeper gloves.

60 Mins- Di referee don give Jordan Ayew yellow card.

59 Mins- Ryan Gravenberch don comot and Jurgen Klopp dey give Cody Gakpo instructions

57 Mins- 1 - 0

Goal! Jean-Philippe Mateta score di penalty.

57 Mins- Jean-Philippe Mateta go take di penalty.

56 Mins- Referee Andy Madley do di VAR signal im don go check whether na penalty for Crystal Palace.

54 Mins- Jean-Philippe Mateta don go down inside di box afta defender challenge am.

53 Mins- Crystal Palace no profit from di corner kick.

53 Mins- Jefferson Lerma pass inside penalty area dey blocked by Liverpool defence. Crystal Palace get chance to score from corner kick.

50 Mins- Jefferson Lerma react well near di penalty spot to attack di ball from the free kick. Im jump high to head di ball but e go wide

50 Mins - Rough challenge from Jarell Quansah and di referee don blow for a foul.

47 Mins- Andy Madley blow im whistle for foul from Nathaniel Clyne

46 Mins- Jurgen Klopp bring in Joe Gomez and Wataru Endo don comot .

46 Mins- Half-time substitution. Odsonne Edouard (Crystal Palace) is replaced by Jean-Philippe Mateta.

Match don start again.

First Half

45+6 Mins- First half don end

45+2Mins- Trent Alexander-Arnold take di corner but dis time Crystal Palace clear di ball.

45+2 Mins- Dominik Szoboszlai collect di rebound to shoot, but im effort dey blocked. Liverpool force anoda corner.

45+2 Mins- Crystal Palace defender block di ball for line afta snap shot from Mohamed Salah inside di box.

45 Mins- 5 min. of stoppage-time.

44 Mins- Corner kick. Liverpool get opportunity.

44 Mins- Wataru Endo solo run, but im no fit create chance as di defence clear di ball.

41 Mins- Rough tackle from Will Hughes. Di referee don blow im whistle for foul.

38 Mins- Joel Ward make one bad challenge im don collect yellow card.

34 Mins- Odsonne Edouard dey ask for medical attention.

34 Mins- Referee Andy Madley decide say no foul from Virgil van Dijk, di game don kotinu.

33Mins- NO BE PENALTY! Referee Andy Madley don change im decision to award a penalty afta VAR review. Di Crystal Palace dey vex.

31 Mins-Wait oh! Efit no be penalty for Crystal Palace as di ref now want review am wit VAR.

30 Mins- Virgil van Dijk bring down im opponent down. Andy Madley blow im whistle for foul. penalty kick for Crystal Palace!

29 Mins- Virgil van Dijk don collect yellow card aft aim commit foul.

26 Mins- Rough challenge from Wataru Endo and Andy Madley don blows im whistle for fowl.

24 Mins: Will Hughes cross di ball in from corner but Liverpool defence clear am.

23 Mins- Luis Diaz make one rough challenge and Andy Madley blows im whistle for foul.

21 Mins- Cross from Jordan Ayew no dey successful as Liverpool defence quickly clear di ball out of di penalty area.

16 Mins- Ryan Gravenberch collects pass inside di box im ways shot but defender blocked am.

16 Mins- Konstantinos Tsimikas take di corner kick but di ball only find di head im opponent.

16 Mins- Trent Alexander-Arnold cross ball inside di box, but di Crystal Palace defence clear di ball to safety. Liverpool get corner.

13 Mins- Mohamed Salah cross ball inside di box, but Sam Johnstone come off im line to catch di ball.

12 Mins- Will Hughes take di corner kick and send one lovely ball inside di penalty area, but di defence clear di ball to safety.

12 Mins- Jeffrey Schlupp try to slide the ball through to im teammate but di defender block am. Crystal Palace get corner kick.

7 Mins- Ryan Gravenberch make one strong challenge and Andy Madley don blow for a foul.

5 Mins- Di linesman raise im flag. Luis Diaz dey offside.

3 Mins- Lack of options for Konstantinos Tsimikas so im long range go wide post.

2 Mins- Joel Ward escapes without any punishment from di referee afta im use excess force to foul im opponent.

I min- Match don start

Mohamed Salah and Odsonne Edouard

Wia dis foto come from, Getty Images

Team news

Crystal Palace line up: Johnstone, Clyne, Andersen, Guéhi, Ward, Lerma, Richards, Hughes, Ayew, Édouard, Schlupp

Substitutes: Tomkins, Olise, França de Oliveira, Mateta, Ebiowei, Ahamada, Matthews, Riedewald, Ozoh

Liverpool line up: Alisson, Alexander-Arnold, Quansah, van Dijk, Tsimikas, Szoboszlai, Endo, Gravenberch, Salah, Núñez

Substitutes: Gomez, Konaté, Jones, Gakpo, Elliott, Doak, McConnell, Kelleher, Bradley, Díaz