China carry one million pipo comot from dia house as storm hit Shanghai
- Author, Kelly Ng
- Published
- Read am in 4 mins
Chinese authorities don evacuate ova one million pipo from dia house for eastern China including di financial capital, Shanghai, as Typhoon Dolphin make landfall.
Di typhoon bring heavy rain and scatta transportation for di area. Dem cancel nearly 1,000 flights for Shanghai alone on Monday.
Even though authorities don downgrade Dolphin to tropical storm, dem still dey warn say heavy rain go continue, heavy flooding dey possible and landslide fit happun on Wednesday as di storm dey move north.
Chinese authorities earlier don issue highest-level red alert for Dolphin, wey be di strongest storm wey don hit China dis year.
E carry maximum wind speed of 150km/h (94mph) wen e first hit Yuhuan for Zhejiang province around 5:30 PM (9:30 AM GMT) on Sunday bifor e land for Wenzhou city about one hour later, meteorological authorities tok.
Dem don forecast heavy rain on Monday for Shandong, Henan, Hubei, Anhui, Jiangsu, Zhejiang and Shanghai cities.

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Getty Images
Govment don tell pipo make dem avoid outdoor activities, while some top tourist location don remain close, including parts of Disneyland and Legoland, and several viewing platforms wey dey along di Bund for Shanghai.
Videos on di state media show as di ground-floor businesses don flood for di old French Concession for Shanghai, di area dey popular for tourism, and pipo dey waka inside water wey don reach dia ankle.
Several state media tok say dem dey find one nine-year-old boy from Wenling, Zhejiang don miss after e carry go water. Chinese officials neva report say anybody don die.
For some parts of Zhejiang rain fit fall reach 250mm to 500mm ova di next few days, according to forecasters.
Authorities for Hangzhou, wey be Zhejiang capital, don cancel parking fees for all public spaces for drivers wey dey find shelter amid di strong wind and floodwaters.
For Wenzhou province, authorities don relocate about 900,000 residents and open more dan 1,000 emergency shelters, while dem don evacuate about 390,000 pipo from dia homes for Taizhou city.
For di coastal province of Fujian, maritime authorities don suspend dozens of passenger ferry routes and don stop more dan 100 offshore construction projects.
Di storm don travel long distance of 6,000km before e land, wey mean say e lifespan don pass three times dat of di average typhoon, according to di China state broadcaster CCTV.
E get big circulation size and intense rainfall capacity, CCTV report.

Wia dis foto come from, Reuters
Misinformation around di storm don dey spread fast fast on di Chinese internet, state media don report say dem don detain two pipo for distributing di content.
One of dem, na 60-year-old man, wey create fake video wit AI, wey claim say someone for Shanghai don fall from one building during di storm.
Anoda man, 32, bin re-edited one storm footage wey oda social media users post to cause confusion.
Dolphin bring torrential rain to di Philippines, part of northern Taiwan and Japan Okinawa island bifor China.

Wia dis foto come from, Getty Images
Eight pipo don died for Philippines becos of di heavy monsoon rain wey bring Dolphin and storms earlier dis week, di Office of Civil Defence tok.
More dan 7,000 pipo dey shelter for evacuation centres nationwide.
For Okinawa in Japan, five elderly pipo don suffer non-life-threatening injuries, according to di prefectural govment.
Three of dem fall becos of di strong winds, e tok.
Meanwhile for Hong Kong, weather observatory post di record high temperature of 36.9C on Sunday as di typhoon carry warm air ova di city.
Typhoon season for di western Pacific dey happun between May and October, wen typhoons dey common.
Dis year na strong El Niño year, wey experts tok say e mean typhoons fit grow to become more intense.










