South Africa beat South Korea to make World Cup history

Published
Read am in 2 mins

Thapelo Maseko second-half strike make history for South Africa as dem reach di World Cup knockout phase for di first time sake of dia victory over South Korea for Monterrey.

Three points move South Africa up to second for di table, behind Mexico, and leave South Korea wey bin hope say dem go finish as one of di best third-placed sides.

South Africa go now face face Canada for Los Angeles on Sunday in di last 32, by 20:00 BST.

Na game wey no too produce excitement as South Africa dey okay as dem dey defend and wait to hit dia opponent wit counter-attack, while South Korea lack quality for front.

Maseko snatch unexpected winner for South Africa, as e take touch to bring di ball to im left leg inside di box before e hit di ball wey pass through di leg of Jens Castrop and inside di near post.

Before dat one, di greatest moments of jubilation inside di stadium bin don come from Mexico fans wey dey inside di stadium as dem dey celebrate dia kontri goals against Czech Republic.

While South Korea bin dominate much of di ball na di African side, wey use dia head to deal wit dem wit counter attacks wey produce di best chances wey bring di goal.

South Korea just manage to threaten South Africa, wit one header by Oh Hyeon-gyu and anoda early shot by Lee Kang among dia chances.

South Africa, wey bin neva qualify World Cup since afta dem host am for 2010, don finish third for evri oda World Cup group stage dem don play.