Death toll for Venezuela earthquakes rise to 188, as rescuers search collapsed buildings for survivors

Published
Read am in 6 mins

Back-to-back earthquakes for Venezuela death toll don rise to 188 and more dan 1,500 pipo get different type of injury, according to di lates reports.

Rescuers dey search di rubble for Caracas and di state of La Guaira, wia di UN say more dan 100 buildings don collapse.

Di earthquakes, get magnitudes of 7.2 and 7.5 wey hit di west area of di capital, and pipo wey dey far away for Bogota, Colombia feel di impact. Di second earthquake na di strongest to hit Venezuela since 1900.

Di earthquake wit magnitude of 7.2 bin strike north of Venezuela shortly afta 18:00 local time on Wednesday (23:00 BST), and di second quake of 7.5 magnitude strike less dan one minute later

Di US Geological Survey earlier calculate 44% chance of more dan 10,000 fatality, and 30% chance of more dan 100,000

Rescuers for di capital dey search through di rubble for survivors and dem dey hear as pipo dey call for help.

BBC reporter Vanessa Silva wey dey report from Caracas say buildings no get power supply and di metro system dey completely closed,

Venezuela bin dey celebrate national holiday, and many pipo bin dey for house wen di quakes happun.

One BBC Journalist write say her sister for Caracas bin send her audio message, "Di house bin just shake horribly. E still dey shake."

Buildings across di kontri capital Caracas don scata and pipo still dey fear say di number go continue to rise.

Di main airport for di kontri dey closed due to damage, afta video show how pipo bin dey run comot from di corridors as di earthquakes dey happun.

BBC Mundo contributor Nicole Kolster tok say dem hear as pipo dey call for help from under di rubble of collapsed building.

"'Ask for help. We dey hia,' na wetin you go hear," she tok.

Afta di quake, oda pipo "still dey outside dey wait for safety in case aftershock happun," Kolster add.

"Di recommendation na make pipo no go back inside di building," she explain.

Maria Elise, one local from di Caracas suburb of Palos Grandes, describe how her apartment "get some cracked walls. Utility poles wey don fall, we no get electricity, no signal."

Di US don pledge medical and humanitarian support as Donald Trump describe di quakes as "massive in scale" wit a "devastating number of deaths".

According to one British school teacher, many buildings for Caracas don pieces and dia walls dey fall down wit visible cracks.

Alan Chung, wey don live for Venezuela for seven years, tell Radio 4's Today programme say im bin dey for restaurant di time wey di quakes happun, bifor im run outside and see cloud of dust" and electricity lines wey dey "explode".

Im tok say pipo for di kontri don master minor earthquakes, but dis one na "di most serious for a long time".

"Venezuelans dey veri resilient," Chung tok.

Wetin cause di earthquakes

Venezuela dey for di seismically active zone wia two tectonic plates, di Caribbean and di South American dey meet.

According to di US Geological Survey, di second and larger of di two quakes wey happun occur as a result of "shallow strike-slip faulting" near di boundary of dis plates.

Dis na wen faults, or fractures between di plates, move horizontally and wen di movement happun quickly.

"While e dey commonly plotted as points on maps, earthquakes of dis size dey more appropriately described as slip ova a larger fault area," USGS report.

Di pair of quakes today "likely indicate a complex, rupture interaction process", di organisation tok.

Aftershocks, including "some potentially wit strong shaking" still dey possible, e add.

Venezuela don experienced two earthquakes back to back and both of dem dey veri shallow, less dan 30km below ground.

One of di important factors wey dey determine di impact of earthquake na how far below di Earth surface wey e happun.

Di closer e dey to di surface di more shaking and potential damage wey go fit happun.

World leaders react to Venezuela earthquakes

World leaders don dey show support for Venezuela sake of di earthquakes wey happun on Wednesday.

France President Emmanuel Macron tok for post on X say im extend solidarity to di victims, dia loved ones, and di pipo wey authorities mobilise.

Spanish Prime Minister Pedro Sánchez says all of im support "and dat of Spain", dey wit di pipo of Venezuela as e add say im and im kontri thoughts dey wit di victims and dia families.

China foreign ministry tok-tok pesin, Guo Jiakun tell tori pipo say di kontri go do wetin dem fit do to help Venezuela. Im add say tori neva dey of any Chinese wey be victim.

President of El Salvador Nayib Bukele say dem don ready to send 300 rescuers and paramedics wit 50 tons of equipment, medicines and essential supplies to Caracas from di kontri.

Earlier, US President Donald Trump bin tok say im don "instruct all agencies of our govment to get ready to move quickly", while Secretary of State Marco Rubio say di kontri bin "immediately send search and rescue teams, medical resources and humanitarian assistance" to Venezuela.

Some foto from di earthquakes