You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Why UK dey always change dia prime ministers?
- Author, Rob Watson
- Role, UK political correspondent, BBC World Service
- Published
- Read am in 5 mins
Sir Keir Starmer don bicom di sixth prime minister to resign or wey voters force comot for di last 10 years.
In case anybodi dey doubt, dis no be di normal levels for British politics. If you no dey convinced, consider dis: since dem create di post of prime minister for di 18th Century, prime ministers don stay an average of five years for office each.
For di last decade, e don shrink to barely 18 months!
So why dis extraordinary turnova? Of course, E get particular reasons for each of di six cases.
David Cameron bin resign for 2016 bicos e bin call and lose di referendum on weda di UK suppose still remain member of di European Union.
Theresa May na also victim of Brexit, as dem bin reject her proposed deal for new relationship between di UK and di EU, until her position bicom untenable.
Dem force Boris Johnson comot sake of im character, integrity and judgement, as im fellow Conservative MPs believe say e don bicom more of liability dan di electoral asset wey e be bifor.
Liz Truss comot sake of di reaction of di financial markets to her plans for tax cuts witout, according to investors, di spending cuts to pay for dem.
Di last Conservative for di list, Rishi Sunak, na di only one wey comot tru election, as voters sack am sake of say dem don tire for di 14 years of Conservative leadership.
As for di latest victim, Sir Keir, e dey comot bicos e don lose di support of MPs from di ruling Labour Party wey believe say e no longer dey popular and e don bicom big threat to dia party.
But ova and above dis individual stories of downfall, e be like say so much more dey go on for di UK wey don make dia politics more brutal and more bloody and di voters more unforgiving and polarised.
So wetin more dey go on?
Deeper unhappiness
Opinion polls, focus groups and oda evidence suggest say di voters dey feel like say politicians neva fully understand di three ogbonge factors wey dey cause dia unhappiness.
Di first na di stagnating standard of living. Dis painful phenomenon date back to di global financial crash of 2008.
So, as we dey look at why di UK don get six prime ministers since 2016, we fit easily start di clock back dat time.
And to put am for context, di standard of living neva shrink like dis since di Napoleonic Wars for di early 19th Century.
Wen pipo dey struggle financially and feel say govment no dey deliver on dat ogbonge promise say di next generation go dey beta off dan di last, e no dey surprising say di mood go ugly.
And to add to di worry of politicians, polls suggest say economic pessimism dey for di highest level since 1978, a time of high inflation and industrial strife.
Di second driver na di sense say notin dey work well for di UK, a feeling of say public services, weda transport, justice or whateva, no just dey deliver.
Dis na consequence of di same low economic growth wey dey also cause di standard of living to shrink.
For dis case, di lack of growth don deprive successive govments of di revenue to invest for infrastructure and all oda tins wey pipo value, like education and healthcare.
Di third driver na di widespread concern ova social cohesion, or rather di perceived lack of am.
Polls suggest say more dan 80% of di pipo feel say di kontri dey divided.
Many pipo dey blame dat feeling of division on di high levels of immigration in recent decades and di failure of some communities wey don already dey for di UK, to integrate.
And, rightly or wrongly, many voters tink say recent prime ministers simply no understand dia anger ova di way dem feel say di UK don change.
So, to put am anoda way, di UK, like oda European kontris, still dey struggle wit di question of how all of dem go get along for a multiracial, multi-ethnic, multicultural and multinational society.
Perhaps di oda tin wey don change, and no be for only di UK e dey happun, na say no be only say pipo dey vex about some tins, but dem no longer dey too restricted to show am.
Weda dat one na di fault of social media or oda factors, pipo dey openly hostile to individual politicians, including prime ministers, in a way wey you fit no even tink am just a few years ago.
Ungovernable?
So, shey di kontri don bicom somehow ungovernable? Shey dat na di reason why di UK go soon get di seventh prime minister in 10 years?
Most politicians no go go dat far. Dem say although governing don bicom more difficult in a more complex world wit more fragmented and divided population, e no dey impossible.
But as six prime ministers don fail to lift di cloud of gloom and pessimism wey be like say e don dey hang ova di UK since di financial crash of 2008 and di Brexit referendum for 2016, pipo go still get dia doubts about weda number seven, whoever e go be, fit dey more lucky.