Nigeria civil defence reveal wetin kpai plenty illegal miners wey dem gbab and lock for dia custody

Wia dis foto come from, Nurphoto/Getty images
Di Nigeria Security and Civil Defence Corps (NSCDC), Niger State Command, don confam say some illegal miners wey dem arrest and put for dia custody don kpai.
Dem say di illegal miners wey dem arrest for M.I Wushishi /Lukoto village allegedly kpai from suspected outbreak of disease.
For statement wey di Commandant of NSCDC, Niger State Command, Suberu Siyaka Aniviye sign, e tok say di arrests na part of dia renewed efforts to stop illegal mining activities.
According to di statement, di NSCDC bin do "burst operation" on 15th and 16th September 2026, wey lead to di arrest of suspected illegal miners and di recovery of exhibits wey bring significant results as dem arrest plenti suspected illegal miners.
Tins change wen dem find out say many of di detained miners don kpai on Thursday morning.
"However, for di early hours of 17th September, 2026, we see say scores of di detained suspects don kpai sake of suspected outbreak of disease.
"Di deadi bodi of di deceased suspects dey for General Hospital, Minna, for further medical examination to establish di actual cause of death," di statement tok.
Di Command dey beg di public and di families of di pipo wey kpai to "remain calm and desist from any actions wey fit lead to breakdown of law and order".
Dem wish di souls of di pipo wey kpai to rest in peace.
Even though di NSCDC no tok di exact number of suspected illegal miners wey die for detention, local media dey report say di suspect wey die na 33, but di BBC neva independently verify dis figure.
Di Nigeria police don also confam di tori say suspected illegal miners die for NSCDC detention facility for Niger State as dem order investigation into di death of di miners.
For statement wey Wasiu Abiodun wey be di tok-tok pesin for Niger State Police Command sign, e say di Commissioner of Police, Niger State Command CP Adamu Abdullahi Elleman, give order make dem start to chook eye for di mata sharp-sharp.
"Di directive come from di unfortunate incident wey occurr for di early hours of today Thursday 17th September, 2026 wia scores of pesins arrested as illegal miners die for custody."
Di Commissioner of Police direct di Deputy Commissioner of Police, SCID Minna to take charge of di investigation to reveal di circumstances wey surround di unfortunate death of di suspects.
Illegal minning dey happun for different parts of Nigeria , mostly for di northern regions like north central.
States lke Plateau, Niger and Zamfara dey face di challenge of illegal minning.
Nigeria govment dey try find solution to dis problem but dem neva get permanent solution.









