Why many Nigerians sleep inside traffic for Lagos

Men on truck
Published
Read am in 5 mins

Thousands of travellers hang for road along Lagos-Ibadan expressway sake of Kara bridge repair join wit accidents wey happun for di area.

Plenti pipo even sleep for road becos dem no fit reach dia house and some trek long distance as vehicles no gree move.

Dis situation get worse from Tuesday 15 September reach 16 September 2026.

BBC News Pidgin go di scene of di long traffic and wetin cause di gridlock na sake of di repair works wey dey happen for Kara bridge for Lagos Ibadan Expressway.

Di repair work start Tuesday last week and since den many pipo don get plenti experience for the high way.

Some pipo don spend nights for di road while some don spend long hours trying to get to dia destinations.

Situation for Tuesday into Wednesday be say di traffic block di roads wey lead into and out of Lagos wey make plenty people sleep over on di road.

Di heavy gridlock continue Wednesday morning as plenty pipo dey stranded inside di traffic and many no fit see ride to go to work and to go to dis business places.

Some pipo decide use motorbike to beat di traffic at very high cost.

According to some of di drivers dey comot go outside Lagos but di traffic no gree and dem gatz stay inside dia vehicle overnight.

According to wetin our reporter see for di scene, bike wey dey normally carry pesin from Magboro axis for Ogun state to Ojodu Berger for Lagos state at 1000 Naira come dey charge as high as 3000 per pesin and dem go still carry two pipo for di bike at double di price.

Bikes wey dey carry pipo from Mowe to Ojodu Berger at 2000 naira come dey charge as high as 5000 to 8000 naira pesin.

Many passengers wey no fit afford di money use leg dey do long trekking.

Some drivers follow one way traffic and dey cause more problems for di already blocked roads.

Govment bin don announce say make commuters follow alternative routes to avoid joining the traffic.

Di alternative routes out of Lagos na Ikorodu road to Sagamu, Ajah - Epe road to Ijebu Ode or di Ota - Abeokuta highway.

E neva still clear wen dis traffic gridlock go stop even though govment announce say di repairs go last about two weeks plus.

Lagos govment beg passengers sake of traffic

"I understand di frustration of Lagosians wey dey go out of Lagos and dose wey dey go to dia various destinations within di city, sake of multiple accident wey involve trucks for Kara Bridge," Babajide Sanwo-Olu tok.

Di Lagos state govnor say di situation get worse sake of di repair wey dey go on for di bridge.

E add say LASTMA officials, emergency response teams, security agencies and oda traffic management teams dey ground to make sure say traffic no too much.

"Di repair work dey expected to last about two weeks. During dis period, traffic go dey managed on di available side of di bridge."

E come beg all di motorists make dey dey patient and obey di directions of traffic officials.

Sanwo-Olu say make evri road users plan dia journey well.

See fotos of di traffic below:

Lorries wey dey inside tarred jam
Wetin we call dis foto, Pipo sleep for road sake of di traffic gridlock for Kara bridge
Lagos traffic jam
Pipo wey dey wait as traffic jam lock road with many lorry and oda vehicles
Wetin we call dis foto, Many pipo dey stranded sale of construction work wey dey go on for di Kara bridge
Construction work on di links for Kara bridge
Wetin we call dis foto, Di na part of di bridge joint wey dem dey repair
Two women wey dey waka on to di kara bridge wia work dey go on
Wetin we call dis foto, Part of di repair area as many pipo gatz waka di stretch of di bridge sake of di traffic jam
Traffic lock jam in Lagos
Wetin we call dis foto, Di traffic gridlock dey extend to oda parts of Lagos
Traffic jam in Lagos
Wetin we call dis foto, Pipo park dia vehicles dey monitor di situation
Traffic jam in Lagos
Wetin we call dis foto, Some pipo dey use leg waka go dia house as motor no dey