'Tins dey happun for football wey you no fit control' - Thomas Partey tok ahead of clash wit England

Published
Read am in 5 mins

Ghana midfielder Thomas Partey don speak for di first time since im Canada visa refusal wahala wey make am miss di kontri World Cup opener versus Panama.

Di 33-year-old inside one pre-match interview wit journalists tok say im dey ready to "fight for di Ghana badge" togeda wit im teammates for di tournament as dem prepare to take of England.

Partey miss di game afta Canadian authroities refuse am visa to enta di kontri sake of im dey face rape charges for di UK.

One appeal against di visa refusal for di Federal Court also fail, as di judge throway di motion say di kontri gatz di right to use dia immigration laws to deny any pesin dem describe as "inadmissible" especially if di pesin dey face criminal charges, or di pesin chop prison sentence or odas for anoda kontri outside Canada.

Ghana win dat game 1-0 bifor di team travel from Canada back to dia base for di US to prepare for di next game.

Di oda Group L teams – England win 4-2 against Croatia for dia opening game. Now Ghana go jam wit di three lions on Tuesday 23 June for di Gillet stadium.

Di pre-match hype for plenti foreign media na whether England players go shake hands wit Partey ahead of di game like how players bin dey shake each oda all di time.

Tori be say di England Football Association allow di players to take dia own decision whether dem go shake di player or not.

Some ex-footballers like John Terry wey bin face some controversies and investigation for im career as player say im go advise di players to shake hands wit Partey, especially as no court bin find am guilty of any crime at dis time.

Wetin Partey tok ahead of di game

Journalists bin ask am how im and di squad dey feel wit hours to di crucial game wit England.

Di 33-year-old tok say "di emotions for camp afta di first game bin dey great wey coming for dis game, everibody gatz compete. We sabi say we go face some of di best players for di World, dis na di reason we dey hia to compete and to give our best."

Some pipo bin worry say since im miss id first game, wey im no play many games for Villarreal for Spain dis season, im go get match fitness, but di ex-Arsenal midfielder say "na part of football, tins dey happun wey you no fit to control but for me now, I dey feel okay wey I dey ready to play."

Wit di chance to play against im former midfield partner Declan Rice, Partey tok say im sabi di quality di England midfielder get, wey im neva go be easy.

"Rice be good player wey I dey happy to play against am and di odas for dis match."

Some of di Ghana players bin dey play for England - bifor di end of last season Fatawu Issahaku and Jordan Ayew bin dey play for di premier league, now Coventry City striker Thomas Brandon-Asante bin get promotion to di premier league.

Ghana left back Baba Rahman also bin play for Chelsea bifor, na so some of di players get experience for how di English football bin dey.

Thomas Partey say im own experience wit Arsenal and im oda colleagues go help dem for dat game.

"No be me alone get experience for English football, many of di players get dat experience also, but I believe say na team sport wey we gatz work on our collective game to compete wit di three lions."

"We don train well wey everibody dey ready to give dia best."

Thomas Partey get point to prove for dis game?

Well, di ex-Atletico Madrid midfielder respond say "no be about personal achievement for me, we dey go play football as a team and for personal level, if I fit contribute wit my best game, I go dey happy; at di end of di day, na team effort wey gatz put up for dey for di highest level."

Ghana coach Carlos Queiroz dey set to select di Ghana midfielder wey get 58 caps and 16 goals for di Black Stars for di game togeda wit youngster Caleb Yirenkyi and Kwasi Sibo.

Di coach say im go choose team wey dey motivated and gatz di energy to play wit di African DNA against England wey im hope say im boys go get di win.