Morocco captain Hakimi go stand trial for alleged rape

Published
Read am in 6 mins

Morocco captain Achraf Hakimi go stand trial for alleged rape, French prosecutors don confam.

One woman bin accuse di Paris St-Germain defender of raping her for im house for di French capital for 2023, wen she be 24 years.

Di public prosecutor office for Nanterre, wey be western suburb of Paris, begin one preliminary investigation for March 2023.

One investigating judge order a trial for February 2026 and French media report say 27-year-old Hakimi bin fail wit recent appeal to get di trial dismissed.

Hakimi release statement ahead of Scotland game

Di Morocco captain go lead im kontri to face Scotland for dia second group fixture for di World Cup afta dia 1-1 draw wit Brazil for Match Day 1.

Hakimi don deny di di allegations since e comot.

Ahead of di Scotland game, di 27-yea-old release statement wia im maintain innocence.

Im write on top im social media page say "di justice system look me for face dey tok say, 'If you neva dey famous, dis case no go even dey for di first place'".

"I bin choose to remain silent for years. I bin believe say di right decision go come as I dey maintain my dignity, wit patience, and trust for di justice system.

"Today, dis story wey no be my story bin dey out dia at di expense of my family, my life, and above all, di truth. I sometimes dey feel like say I don become easy target.

"I don wait for dis trial since and now I dey wait eagerly. Finally, I go fit speak."

Rachel-Flore Pardo, wey be di lawyer for di plaintiff tok inside one statement: "Afta more dan three years of legal proceedings, and afta my client story bin dey dragged for mud by Achraf Hakimi defence, wey dem defame her, na dis decision for trial dey bring her relief and hope.

"Relief say di justice system don hear her story wey dem go give her di right to trial.

"Hope say dis trial go help oda women and further weaken di wall of denial and impunity surrounding sexual violence, wey dey happun for di world of men football."

Di court no set date yet to begin di trial.

Morocco dey play all dia three group stage games for di United States, wia di team don base at di moment.

But if di Atlas Lions progress to di knockout stage, Hakimi fit suffer to enta Canada or Mexico if dia matches dey outside di United States.

Ghana midfielder Thomas Partey bin miss Ghana game against Panama on 17 June afta Canadian authorities bin deny am entry sake of im dey face rape charges for di UK.

Di player and di kontri bin file appeal for Canadian federal court to challenge di visa refusal, but afta di court hear arguments from both sides, dem dismiss di appeal wey dem uphold di visa refusal by immigration authorities.

Partey, 33, don plead not guilty to seven charges of rape and one count of sexual assault wey dey relate to allegations by four different women between 2020 and 2022.

Im trial go begin for June 2027.

Canada govment say dia kontri fit deny pesin visa or entry into di kontri if di pesin dey face charges, chop conviction or dey di process of facing trial for crime wey fit end up in 10 years jail-term for Canada.

Also Ivory Coast striker Elye Wahi first chop bounce wey dem deny am visa to enta Canada for dia World Cup game against Germany.

Dem bin arrest di Nice forward last month bifor di World Cup ova allegations of spot-fixing for Ligue 1.

Di 23-year-old striker chop accuse say im intentionally collect yellow card for dia game against Metz for May dis year.

Spot-fixing na di practice wia pipo go intentionally do tins to affect match incidents in a way wey go make pipo wey dey bet, to make profit.

One statement from di public prosecutor office for Marseille confam say di 23-year-old football player dey compete for Ligue 1 and e chop arrest, even though dem no mention di player name.

However, Ivorian football federation inside one statement later confam say di player go dey part of di team to travel for dia second game.

Di AFP news agency report say Canadian officials bin delay Hakimi visa authorisation afta dem request more information about im legal situation, bifor dem allow am entry.

"Di federation don welcome dis positive outcome wey we don tank di various parties wey help to handle dis mata."

One tok-tok pesin for Immigration, Refugees and Citizenship Canada (IRCC) tell BBC Sport: "Canada bin dey consistent say to dey host major event no mean say we go change Canada immigration laws."

"Everi pesin wey wan enta Canada dey assessed individually based on di facts wey dey available and di law wey bin dey apply, while maintaining di safety and security of Canadians as top priority.

"For exceptional circumstances, we fit grant temporary resident permit to pesin wey dey inadmissible or no dey meet di requirement to enta or remain temporarily for Canada."

Di World Cup dey happun across all three co-host kontris until di quarter-final stage, wen e go dey exclusively for di US.

Hakimi, wey play 97 games for Morocco, bin play im first game for 2016 at di age of 17.

Im be key pesin for di Morocco team wey become di first African kontri to reach di semi-finals of di 2022 World Cup for Qatar.

Di defender bin join Paris St-Germain from Inter Milan for 2021, wey im win 13 titles during dis time - wey include back-to-back Champions League titles for di past two seasons.

Im also be di reigning Caf player of di year.