Bruce Willis: Razzies cancel 'worst performance' award sake of health issues

Wia dis foto come from, Getty Images
Organisers of Razzie Awards, wey dem dey give to di worst feems of di year don cancel di recent "honour" wey dem give actor Bruce Willis afta di announcement about im health issues.
On Wednesday, im family reveal say im get brain disorder wey dey known as aphasia.
Ceremony bosses say e "no dey proper" to award prizes to pipo wey dia medical conditions fit don affect dia performance.
Dem bin give Willis im own category for worst Bruce Willis performance for 2021.
Out of di eight feem wey dem nominate, dem judge Cosmic Sin as di best winner.
Di oda movies wey dey drag di award bin include American Siege, Apex, Deadlock and Out Of Death.
Razzies release di names of di pipo wey go collect dis year award wey dem dey also call di Golden Raspberry Awards, on Saturday.
Some days later, announcement come say Willis dey step away from im acting career afta hospital discover say im get di condition wey affect pesin ability to speak and write.
End of Di one wey oda users dey read well well
Willis, 67, popular for im role wey im play as John McClane for Die Hard feems, wey make am star.
Razzie organisers say dem reach dia decision afta "much thinking and consideration".
"If pesin medical condition na factor for dia decision making and/or dia performance, we acknowledge say e no dey proper to give dem Razzie," dem tok.
Willis retire sake of aphasia
Di American actor wey pipo sabi from oda feems like Armageddon and The Sixth Sense go retire from acting afta dem diagnose am with aphasia wey be condition wey dey make am difficult for pesin to tok or write.
Na im family, plus im wife, Emma Heming-Willis and ex-wife Demi Moore, announce dis one on Instagram on Wednesday, 30, March.
Di statement tok say, aphasia "dey affect im cognitive abilities".
Willis, wey be 67 years, dey popular for im character as John McClane for di Die Hard feems, wey make am celeb.
Im family write for joint statement say, "wit plenti consideration Bruce dey step comot di career wey mean alot to am. Dis na very challenging tim for our family and we dey very grateful for una continuous love, compassion and support".
Willis get five daughters, three wth Ms Moore and two Ms Heming-Willis.

What is Aphasia?
According to di National Institute on Deafness and Other Communication Disorders (NIDCD), Aphasia na disorder wey dey result from damage to portions of di brain wey dey responsible for language. For many pipo, dis area dey for di left side of di brain. Di disorder dey normally occur suddenly, maybe afta stroke or head injury, but it fit also start slowly, sake of brain tumour or progressive neurological disease.
E dey make am hard for pesin to read, listen, tok, type or write but na di toking palava dey common pass as di pesin wey dey suffer di disorder fit dey put words togeda wrongly.

Who be Bruce Willis
Dem born Willis as Walter Bruce Willis on March 19, 1955, for West Germany.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
E start im acting career for early 1980 but but e no blow until di ABC TV series Moonlighting and den for 1988 performance wen e act as John McClane for di first Die Hard film.
Since den, im feems like The Sixth Sense, Armageddon and Pulp Fiction don gross more dan $5bn worldwide, according to Variety.
Im don dey nominated for five Golden Globes. E win one for Moonlighting, and e don win two Emmys.
Reactions from celebs

Wia dis foto come from, Getty Images
Several actors and oda stars don offer dia condolences to Willis and im family afta di news of im diagnosis.
"Grace and guts! Love to you all!" actress Jamie Lee Curtis write for response to Demi Moore's post.
"Sending lots of love and healing to you all!" na wetin journalist Katie Couric write.













