Benjamin Netanyahu: Israel prime minister 12-year hold on power end afta parliament approve new government

Wia dis foto come from, EPA
Benjamin Netanyahu don lose im 12-year hold on power as Israel parliament approve new coalition government.
Right-wing nationalist Naftali Bennett, of di Yamina party, na im go take over as di new prime minister.
Mr Bennett go hold di office until September 2023 as part of a power-sharing deal.
E go den lead a coalition of parties wey dem narrowly approve with a tiny majority vote of 60-59.
E go hand over to Yair Lapid, leader of di centrist Yesh Atid, for anoda two years.
Mr Netanyahu - Israel longest-serving leader wey don dominate dia political landscape for years - go remain head of di right-wing Likud party and go become leader of di opposition.
Speaking for di Knesset (parliament) debate wey stamp di new goment, e say: "If na our destiny to be in di opposition, we go do am with our heads high until we take down dis bad goment, and return to lead di kontri our way."
For im part, Mr Bennett, wey dey lead Yamina, thank Mr Netanyahu for im service to di kontri and pledge never to allow Iran to acquire nuclear weapons.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Getty Images
Wetin happun?
Mr Netanyahu bin serve five terms, first from 1996 to 1999, den continuously from 2009 to 2021.
E call for election for April 2019 but fail to win enough support to form new coalition goment. Two more inconclusive elections follow.
Afta di third one, e form goment of national unity with di den-opposition leader Benny Gantz, but di deal collapse and Israel go back to di polls for March.
Likud come out as di largest party, but afta Mr Netanyahu dey unable again to form goment, di job pass on to Mr Lapid, wey im party come second.

Wia dis foto come from, Reuters
Opposition to Mr Netanyahu stay in power grow, not just among di left and centre but also among right-wing parties wey dia ideology originally bin align to Likud, including Yamina.
Although Yamina come joint fifth for di election with only seven seats, dia support bin dey critical. Afta weeks of negotiations, Mr Lapid bring Yamina on board as part of a group of parties wey dia only common goal na to remove Mr Netanyahu from office.
Dem sign di agreement wey involve eight factions with di 61 seats wey dey required for a majority on 2 June, just half an hour before di deadline bin dey due to expire, na dat one bin stamp Mr Netanyahu fate.
Who be Naftali Bennett?

Wia dis foto come from, Reuters
Naftali Bennett serve as Chief of Staff to di Prime Minister from 2006 to 2008 until dem get kwanta. E comot oga Netanyahu party go join di right-wing national religious Jewish Home party. Im also become member of parliament afta e make im party win for di 2013 election.
E bin serve as minister for every coalition goment until 2019, wen im newly formed New Right alliance no win any seats for dat year election. Eleven months later, oga Bennett return to parliament as head of Yamina party.
Naftali Bennett dey open for im support for Israel as di Jewish nation state and Jewish historical and religious claims to di West Bank, East Jerusalem and di Syrian Golan Heights - territory wey Israel don occupy since di 1967 Middle East war.
Oga Bennett political rise follow im success for military and business.
Im serve for two branches of di Israeli special forces during di time e dey for army. Later e start im tech companies and become multimillionaire in di process.












