Christopher Plummer: Sound of Music star wey act Captain Von Trapp for di 1965 award winning movie don die at 91

Christopher Plummer circa 1965

Wia dis foto come from, Getty Images

Published
Read am in 2 mins

Christopher Plummer, di ogbonge Canadian actor wey pipo sabi for im role as Captain Von Trapp for The Sound of Music, don die at di age of 91.

He win Oscar for im role for di 2010 film Beginners and dem also nominate am for The Last Station for 2010 and All the Money in the World for 2018.

For di film All the Money in the World, e replace Kevin Spacey, wey dem comot im complete performance as billionaire J Paul Getty.

Im many oda films include The Man Who Would Be King and Knives Out.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

According to reports, Plummer die peacefully for im home for Connecticut with im wife Elaine Taylor by im side.

Lou Pitt, im long-time friend and manager of 46 years, remember am as "an extraordinary man wey deeply love and respect im profession".

Di Von Trapp family for Sounds of Music

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Di Von Trapp family for Sounds of Music

"E be national treasure wey deeply love im Canadian roots," e continue. "Through im art and humanity, e touch all of our hearts and im legendary life go endure for all generations to come.

"E go forever be with us."

Christopher Plummer circa 1965

Wia dis foto come from, Getty Images

Plummer get different career path across film, television and theatre, e act inside productions for Broadway and with di Royal Shakespeare Company.

Yet pipo go forever know and love am for The Sound of Music, wey dem adapted from di Rodgers and Hammerstein musical, for wear e act alongside Dame Julie Andrews.

Christopher Plummer

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, He win Oscar for di role for di 2010 film Beginners and dem also nominate am for The Last Station for 2010 and All the Money in the World for 2018.

Plummer get mixed feelings towards im best-known film, wey e famously rename The Sound of Mucus for inside interviews.

E also likened working with Andrews to "make pesin hit you over di head with big Valentine's Day card, every day", though dem later become great friends.