'Keeping Up with The Kardashians' American television series dey end afta 14 years & many spin-off - Kim and Khloe Kardashian announce

Keeping Up with The Kardashians

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Kardashian-Jenner family for 2016. From left to right: Khloe, Lamar Odom, Kris, Kendall, Kourtney, Kanye, Kim, Caitlin and Kylie
    • Author, Faith Oshoko
    • Role, BBC Pidgin
  • Published
  • Read am in 2 mins

Di Kardashian family don announce say dem dey end dia popular show, Keeping up with di Kardashians afta ova 14 years for air.

For statement wey di family release on dia invidual social media handles, di decision na one dey make as family and dem dey grateful for di opportunity di show give dem.

Di show bin take us through di life of di Kardashians, Kim, Khloe, Khourtney and Rob and dia Jenner sisters, Kendall and Kylie.

Keeping Up with The Kardashians

Wia dis foto come from, Instagram/@kimkardashian

Wetin we call dis foto, Kardashian sisters - Keeping Up with The Kardashians start for 2007
Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

'Keeping Up with The Kardashians' television series waka wit dem through weddings (Khloe and Kim), births, and even wen dem tiff Kim engagement ring wey Kanye give am foo Paris hotel.

Di Kardashian na Armenian-American family and gain prominence wen dia pap, Robert Kardashian bin work as O. Simpson lawyer and also Kim Kardashian sex tape.

Keeping Up with The Kardashians

Wia dis foto come from, Kim Kadashian/Twitter

Di show don create up to five or more spin-off shows and plenti businesses for di family like Dash wey di Kardashian sisters start togeda and di Kylie Cosmetics wey turn billion dollar business.

Di family na also di most followed for inside social media.

Dem announce say di last seaseon of di show go air next year (2021).

Keeping Up with The Kardashians

Wia dis foto come from, Kim Kadashian/Twitter

Wetin we call dis foto, Di Kadashian sisters

Most of di Kadashian family become popular wen di show start for 2007. Kim bin don appear inside some episodes of her friend Paris Hilton's reality show and her attorney father, Robert, bin dey known for defending OJ Simpson during im unpopular murder trial. Robert Kardashian die for 2003.

Early shows bin focus on di lives of Kim and her sisters Kourtney and Khloe and dia partners, including Kourtney's ex-boyfriend Scott Disick, Kim's ex-husband Kris Humphries and Khloe's ex-husband Lamar Odom.

How to watch Keeping Up with The Kardashians

If you want a full TV subscription then di easiest way for west Africa- where you fit watch episodes of di series na on E! Entertainment (DSTV or Gotv Channel). If you no want a full TV subscription you fit use pay per view platforms Google Play or Youtube to get episodes for just under £2 each - or for a little extra you fit get dem on iTunes for £2.49 per episode.