You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Hachalu Hundessa: Death of popular Ethiopian protest singer cause big kasala
Demonstrations don break out for Ethiopia following the shooting dead of musician Hachalu Hundessa, wey popular because of im political songs.
Atleast three pipo don die during protest for one town and several odas dey seriously injured for violent protests, doctors bin tell di BBC and di protesters bring down di statue of Emperor Haile Selassie papa.
Di 34-year-old wey im songs focus on di rights of di Oromo ethnic group for equality, bin don tok say im dey get death threats.
Di police say na unknown gunmen kill am on di evening of 29 June and say dem still dey torchlight di killing, wey happun just outside di capital, Addis Ababa.
Tori be say goment don shutdown internet and Police use tear gas to scatter di crowd.
'No be just entertainer'
By Bekele Atoma, BBC Afaan Oromo
Hachalu na pesin wey big pass to call am singer and entertainer.
Im na symbol for Ethiopia largest ethnic Oromo pipo wey don dey para say regime after regime for di kontri no dey treat dem well.
End of Di one wey oda users dey read well well
For one of im song: "No wait for help to come from outside, na dream wey no fit come true. Rise, make your horse ready and fight, na you dey close to di palace."
Dem jail Hachalu for 5 years sake of say im follow do protest when im be 17 years old. Even when many pipo escape, im decide to stay for di kontri to ginger di youths to do I-no-go-gree.
Prime Minister Abiy Ahmed and World Health Organisation oga Dr Tedros Ghebreyesus - wey be Ethiopian - bin don send condolence message.