Bosco Ntaganda: DR Congo Rebel leder dey go prison for 30 years

Wia dis foto come from, AFP
One former Congolese rebel leader don dey sentenced for 30 years for war crimes and crimes against humanity.
Na di Judges from di International Criminal Court (ICC) find Bosco Ntaganda, aka "Terminator" guilty ontop 18 counts wey include murder, rape, sexual slavery and using pikins as soldiers.
ICC bin find for July say fighters wey bin dey support Ntaganda kill pleti civillians for massacre.
Dis na di longest sentence di ICC don ever give.

Wia dis foto come from, Getty Images
Dis tori fit get tins wey go disturb some pipo.
For di court ruling, judge Robert Fremr go through wetin Ntanganda men don do wet include raping a 13 year old pikin wey lead to her need for years of surgeries and her fear sotay she gats drop put of school.
But e tok say even with di way wey im crimes bad reach, e no deserve life sentence. Ntaganda don already dey appeal di mata.
Who be Bosco Ntaganda?
- Dem born am for 1973 for Rwanda wia im grow
- Im run go DR Congo as teenager afta dem begin attack im towns pipo Tutsis
- For 17, im start to dey fight beween rebel and soldier for both Rwanda and DR Congo
- 2002-2003: E become militia leader for di Congolese region of Ituri
- 2006: ICC catch am sat im dey hire pikin soldiers for Ituri
- Bin lead di army ery kill 150 pipo for di 2008 Kiwaji massacre
- 2009: Join di Congolese national army, wia e become general
- 2012: Comot di army wey start rebellion wey pursue 800,000 comot from house






