Andre Gomes: Everton Midfielder get serious injury

Andre Gomes

Wia dis foto come from, James Baylis - AMA

Published
Read am in 1 mins

Everton midfielder Andre Gomes go do operation on Monday afta im get serious ankle injury.

Di injury happun 77 minutes during Sunday Premier League match against Tottenham for Goodison Park.

Dem rush Gomes straight to hospital wia doctor say im get fracture dislocation for im right ankle.

Son Heug-min wey bin dey shattered afta im tackle Gomes chop red card and dem send am out of di field for di 79 minutes.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Wen di tackle first happun, e be like say na small tin, but as di players mode change, fans begin understand wetin really happun.

Di match eventually end 1-1 afta Cenk Tosun hea di ball inside net for di 97 minute.