Toni Morrison: Nobel Prize-winning author don die

Toni Morrison

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Morrison novels include The Bluest Eye, Beloved, Paradise and Love
Published

Nobel Prize-winning US author Toni Morrison don die at di age of 88.

Di Morrison family confirm di tori "with profound sadness" say Morrison die afta "short illness".

Di author of 11 novels also win di Nobel Prize for Literature for 1993, afta she publish her first novel, The Bluest Eye, for 1970.

Her 1987 book Beloved, tell di tori of one runaway female slave, dem turn am to feem wey Oprah Winfrey act for 1998.

Toni Morrison

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Toni Morrison pictured for 1979

Di Morrison family statement say di "extremely devoted mother, grandmother, and aunt die peacefully last night [August 5] surrounded by family and friends".

"Di ogbonge writer wey gbadun anything dem write, whether her own, her students or others, like to read well-well and dey feel at home wella wen she dey write,".

"Although her death na big loss, we dey grateful say she live long and well." Di statement tok.

Toni Morrison and President Obama

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Obama give Morrison with the Presidential Medal of Freedom

Tony Morrison fiction novels

  • The Bluest Eye, 1970
  • Sula, 1973
  • Song of Solomon, 1977
  • Tar Baby, 1981
  • Beloved, 1987
  • Jazz, 1992
  • Paradise, 1997
  • Love, 2003
  • A Mercy, 2008
  • Home, 2012
  • God Help the Child, 2015

Former President Barack Obama wey join oda ogbonge pipo to remember Morrison on Tuesday say she be "national treasure".