Katie Bouman: Di woman wey dey behind first black hole image

Katie Bouman wey be computer scientist don collect plenti accolade worldwide for di role wey she play to develop di algorithm wey create di first-ever black hole pishure.
Di 29-year-old lead development of di computer program wey make di breakthrough image possible.
Dem release di ogbonge photo, wey show dis circle of light of dust and gas 500 million trillion km from Earth, on Wednesday.
For Dr Bouman, di creation make her realise wetin many pipo bin don believe say dey impossible.
She start to make di algorithm three years ago while she bin graduate student for di Massachusetts Institute of Technology (MIT).

Wia dis foto come from, Reuters
For dia, she lead di project wey team from MIT's Computer Science and Artificial Intelligence Laboratory, the Harvard-Smithsonian Center for Astrophysics and di MIT Haystack Observatory assist.
Before dem bin release di photo, she post for Facebook say she no belief as di first image she ever make of black hole dey "in di process of being reality"
Dr Bouman, wey now be assistant professor of computing and mathematical sciences for California Institute of Technology, insist say di team wey help her deserve equal accolade too.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di effort to capture di image, using telescopes for locations wey range from Antarctica to Chile, involve a team of more dan 200 scientists.
"No one of us fit do am alone," she tell CNN. "E come togeda because of plenti different pipo from many different backgrounds." Na so Dr Bouman tok.











