Ogun state police tok how couple allegedly kill dia friend afta putting sleeping drug for her food

Published

Ogun State Police say dem dey investigate one mata wey involve one couple wey allegedly sell dia friend body part afta dem kill am.

Di incident bin happen for Abeokuta Ogun state Southwestern Nigeria.

Police narrate wetin di couple allegedly tell dem during interrogation say, "di lady bin come visit dem and dem cook noodles and egg for her, dem put sleeping pills inside di food. After she eat, she sleep and na for dia dem twist her neck and begin cut her body. "

BBC Yoruba follow authorities tok about wetin really happen.

'How e happun'

Alhaji Moshood Ogunwoolu, wey be Chief of Lemo area for Abeokuta, tell BBC Yoruba about how dem discover body parts for di area.

Di chief say pipo wey dey stay around di couple bin alert am and allege say sometin dey smell inside "Ghana must go" bag wey pesin drop near river and dem try check wetin dey inside and discover say na human leg and arm dey dia.

Dem report dat one to police and police bin advise make dem bury di parts.

E add say di second day around 11:30pm, pipo bin still come allege again say sometin dey smell from di arrested couple house, na den dem carry waka go di house go search before dem discover human intestines and oda parts wey remain inside one plastic container wey dem allegedly keep dey wait dia customer.

Wetin police tok for di mata?

Police tok-tok pesin for Ogun state Chief Abimbola Oyeyemi follow BBC Yoruba tok about di mata.

E explain wia di investigation don reach and e say dem go make sure say di right punishment dey served to dose wey dey involved in di mata and dem go cari all di suspects go court.

Oga Oyeyemi also advise pipo to always tok wia dem dey go anytime sake of say: I dey come no be address wey somebody fit take find pesin wey lost.

Di accused don tok?

At di moment, di accused dey police custody as dem dey interrogate dem and investigate di mata.

Di accused couple neva get lawyer and goment no go give dem one until dem charge dem go court and dem request give judge make di court help dem get lawyer.

Na dat time di state go appoint one give dem.

Meanwhile, di accused couple relatives no wan chook mouth inside di mata. Dem dey concerned say police tok say di couple confess say na dem kill di deceased.

BBC Pidgin still dey chook eye for di mata to try reach out to di lawyer of di accused couple once dem get one.

Ritual Killings for Nigeria and how authorities dey respond

Crimes wey dey related to alleged ritual killing and kidnap for ransom don dey on di rise for Nigeria according to police.

Recently, di police for Ogun state arrest three teenagers wey kill dia friend girlfriend, Sofiat Kehinde for money rituals.

Dem also discover di dismembered body of one unknown pesin wey dem see for swamp area for Leme area of Abeokuta about one week ago.

For di same Ogun state, di Police command on 13, February release statement say some angry residents overpower dia officers for station, for Oja Odan divisional headquarters to kill suspects wey dem allegedly bin gbab wit fresh human head.

Police say dem allegedly bin find fresh human head wit di suspects, dem bin take dem to station for interrogation.

Di issue of ritual killing don become mata of discussion for public spaces wey make members of di House of Representatives wan di federal goment to declare national emergency on ritual killings for Nigeria.

Di Deputy Minority Leader of di House of Representatives, Toby Okechukwu wey raise di alarm on di increase in di rise of ritual killings blame Nigeria Nollywood movies say e dey promote am.

According to Okechuckwu, while citizens of oda kontris dey embrace science and technology, Nigerian youths dey turn to ritual killings.

"While youths for oda climes dey embrace science and technology as way of maintaining pace wit our dynamic world, some of our youths dey hold on to mistaken belief say sacrifice of human blood na di surest way to get wealth, safety and protection," e tok.

Oga Okechukwu add say "ritual killing don become di major theme for most homemade movies and if e no dey checked, our younger generation fit begin to see am as normal tin.