Public Holiday Ghana 2022: Easter Day, Independence, Labour dates and oda holidays as Ministry of Interior release

Published
Read am in 1 mins

Ghana Ministry of Interior don release di public holidays wey go happen for 2022 for di kontri.

According to di schedule dem release, Public Holidays in Ghanaians go observe holidays up to 13 times for 2022.

Dis holiday mean say banks, businesses, schools and goment offices no go dey open dat day.

For statement dem release di dates of di holiday.

Howeva, di dates wey Eid-Ul-Fitr and Eid-Ul-Adha fall on neva come out yet on top say di day of those events fit change.

Dem include:

  • 1 January - Saturday - New Year Day
  • 7 January - Friday- Constitution Day
  • 6 March - Sunday - Independence Day
  • 15 April - Friday - Good Friday
  • 18 April - Monday - Easter Monday
  • 1 May - Sunday - Labour Day
  • 2 May - Monday - Labour Day Holiday (Dis na because labour day fall for Sunday)
  • - Eid ul Fitr
  • - Eid ul Adha
  • 4 August - Thursday - Founders Day
  • 21 September - Wednesday - Kwame Nkurumah Memorial Day
  • 2 December -Friday - Farmers Day
  • 25 December - Sunday - Christmas Day
  • 26 December - Monday - Boxing Day

Ghana dey also observe commemorative days wey mean say na days dem dey celebrate but Public Holidays no dey for am.

Dem include African Union Day on di 25th of May and Republic Day on di first of July.