Awo-Omamma Imo state: Wetin happun for di community wey lead to di burning of house and property?

Screen grab of videos wey dey circulate for social media

Wia dis foto come from, others

Published

Di Nigeria army don comot to tok about wetin happun for Awo-Omamma community for Imo State on Monday, 22, November, 2021.

Dis na afta pipo begin circulate videos of houses, cars and shops wey dey burn for di area on social media.

For inside di videos, we hear residents dey shout, try run around to find water to quench di fire.

Some of di residents wey dey affected also dey cry and pipo dey try console dem for inside some of di video.

One eyewitness wey follow BBC Pidgin tok say some hoodlums bin attack members of di Nigerian army for Ishieke junction for Awo-Omamma and kill one of dem.

"Dem zoom off towards Ihiala for Anambra State and later sojas come enta di area and begin cause havoc for di area as dem set one hotel, cars, houses and shops on fire." Na so di eyewitness tok.

Anoda eyewitness wey no wan make we mention im name say wen dia motor reach di junction, im see some angry sojas wey tanda for dia dey check everybody.

"Sometin fit don vex dem. I no know but dem look really angry . First dem no wan make our motor pass but later dem ask everybody to comot from inside di car .

Di eyewitness say im see cars and filing station wey don burn down and im believe say di sojas fit don do am.

For inside statement wey di Acting Deputy Director Army Public Relations of 82 Division Nigerian Army, Abubakar Abdullahi sign, di Nigeria Army confam say true-true, dem lose one of dia sojas wen dem dey try discharge hoodlums for di area.

Dem also explain wetin happun wey cause katakata for di area.

Wetin Nigerian Army tok

Nigerian Army tok say on Monday 22 November 2021, di troops wey dey do exercise GOLDEN DAWN bin scata IPOB/ESN hoodlums wey dey set fire of pipo property as dem dey try force di 'illegitimate Sit-at-Home order' wey di proscribed group bin force on Awo-Omamma Community, Oru East Local Government Area of Imo State.

Army say, as dem- IPOB/ESN criminals bin wan force citizens to follow di unlawful order, dem begin harass, intimidate and physically abuse pipo wey dey go about dia lawful business.

Soldiers for Ntak Ikot Akpan

Wia dis foto come from, Dianime Uko

Wetin we call dis foto, Soldiers for Ntak Ikot Akpan

Dem later begin set fire and destroy shops and pipo house for Ishieke junction (along Owerri-Onitsha express way) as punishment against di citizens say dem no follow do sit-at-home.

According to di Nigerian Army, di hoodlums block highway, burn one commercial motor wey dey travel go Onitsha.

Vigilant troops later respond to distress calls from motorists and shop owners and dem sharperly move to di scene and begin ffight wit di hoodlums.

Tori be say di troops overpower di hoodlums wey force dem to run for different directions.

Di statement say dii troops come pursue di hoodlums to dia hideout for Akatta Community for Oru East LGA, wia dem neutralise one member of di group inside one shootout.

As di troops engage di hoodlums for wia dem dey hide, oda members of di group wey accuse some individuals say dem give sojas informate for Ishieke junction go burn houses and businesses of law abiding citizens.

Di troop come later return to di junction to pursue di hoodlums and na dia one of dia sojas die.

Di Nigerian army say since di sad events wey happun on 5 April 2021 wen some jaguda pipo bin break inside di Custodial Centre for Owerri and free more dan 1,800 inmates, di rate of criminal activities like kidnapping, car jacking, robbery, unwarranted killing and arson for Imo State don increase.

Di Nigeria Army say dem launch Operation Golden Dawn exercise for Imo State, to protect South Easterners wey dey return to di region for Christmas period.

Di Nigerian army

Wia dis foto come from, others

Wetin be Operation Golden Dawn?

Di Commander 34 Artillery Brigade Obinze, Brigadier General Raymond Utsaha, say di operation Golden Dawn Military camp in Orlu, Imo state.

Utsaha say di operation wey go last till di end of di year, go among other things make sure say di economic activities of di South East continue to dey improve.

"Di exercise operation Golden Dawn na to build on di gains so far wey we don record over di menace of IPOB and ESN by di security agencies so far.

"All security agencies get hand for di exercise." im tok.

Di operation start for October and e go end for December 31, 2021.

In recent times Nigeria security operatives don blame most attacks across di southeast on di ESN security outfit wey IPOB leader Nnamdi Kanu set up.

Nnamdi Kanu

Wia dis foto come from, AFP

Who be IPOB/ESN

Since afta di 1967 Nigerian civil war popularly known as di "Biafra War" many groups don dey agitate for di Igbo speaking part of Southern Nigeria to go dia separate way.

Dis groups include di Indigenous People of Biafra [IPOB] and di Movement for Actualization of Sovereign State of Biafra [MASSOB]

Separatist leader, Nnamdi Kanu na im form IPOB for 2012 and many believe say dem be breakaway branch from MASSOB wey Ralph Uwazirike establish for 1999.

Di Nigerian goment declare IPOB as terrorists group and ban dia activities say e no follow law.

By 2020 Nnamdi Kanu form Eastern Security Network [ESN].

Kanu form ESN to provide internal security against herders invasion of farmlands for di Igbo speaking south-eastern region of Nigeria.

Di immediate cause of di recent agitation for Biafra inside Nigeria start again wen Nigeria goment arrest IPOB leader, Nnamdi Kanu for 27 June, 2021.

Kanu wey dey for DSS custody dey face five count charge of terrorism. although im don plead not guilty to all di charges.

To protest im arrest and detention, Members of di separatist group later declare a sit at home order.

Pipo dey play ball for street for Orlu
Wetin we call dis foto, Pipo dey play ball for Orlu street

Di weekly sit-at home dey ground economic activities for all di states of di Southeast region every Monday.

South east residents continue to obey di order sake of fear of attack by extreme members of di banned group.