Nigerian oil spill: Santa Barbara River spoil wit weeks oil leak from AITEO OML 29 well1

Wia dis foto come from, Japus Ekine
One oil and gas well wey leak inside Nembe, Bayelsa State, southern Nigeria still dey pour for di pass two weeks afta di oil spill occur.
OML-29 Well-1 wey Aiteo Eastern Exploration and Production Company Ltd dey operate don dey pour for more than 14 days none stop.
Di oil spill empty into River Santa Barbara for Nember and e don spread near Kula, a coastal community for neighbouring Rivers State.
Di spill wey happen sake of alleged equipment failure don pollute rivers, waterways and farmlands.
E don affect economic activities, pipo for di local communities wey be mostly fishermen no fit do any fishing activity since di oil spill happen on 5 November, 2021.
Tori be say one four-year-old pikin for Nembe dey feared dead from alleged methane gas poisoning as a result of di oil spill.
Ekine Japus, di President of Kula Youth Organizations Worldwide tell BBC Pidgin say di oil spill don spread cover di creeks and waterways.
And e affect over 10 Kula communities wey include Aberebiya, Barapakama, Angbakiri, Kalawo kiri, New Camp and Inemaboko.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di oil spill also affect Robert kiri, Ofoinama, Belema and Kula main town.
"Since dis oil spill happen, our pipo no fit go fishing because all di water dey polluted.
"Our women sef no fit go pick periwinkle because all di mangroves dey covered wit crude oil from di spill and e dey spread to oda villages.
"Three days ago we go visit di area to see di level of devastation and e dey massive." Di youth leader tok.
"Evri wia dey smell. We don report to NOSDRA and even write to di oil company AITEO but we never get any response." E add
Ekine Japus tok say "We also don report to DSS, di local goment council and to di State Ministries of Environment and Local goment affairs."
"Wetin we want na for dem to stop di spill from di well head as e still dey spill crude oil.
"And for di company to come clean up di area and pay compensation to di pipo because dem no fit do anytin since day time." Na so Oga Japus conclude.
'We go hold AITEO responsible' - Bayelsa State Goment

Wia dis foto come from, Japus Ekine
Bayelsa State Goment say dem no happy say weeks after, AITEO Oil Company never do anythin to stop di oil spill for OML 29 Santa Barbara.
For statement wey di Commissioner for Information, Orientation and Strategy sign, say:
"AITEO never take any concrete step since 5 November, 2021 wen dem report equipment failure."
Ayibaina Duba come wonder why di oil spill go still dey continue even wen di company dey aware of di situation.
"Make AITEO no assume say we no go hold dem responsible for dis criminal neglect of dia facilities and disregard for human life and environment wey dem don show."
Di statement say make AITEO prepare for di consequences of dis failure as di goment no go stand by and allow dem put human and aquatic live for di encore for danger.
Di commissioner come advise pipo wey dey stay for di area to dey peaceful as di goment dey committed to dia wellbeing.
Wetin AITEO don do about di oil spill?

Wia dis foto come from, Japus Ekine
AITEO Eastern Exploration and Production Company operator of di NNPC/AITEO Joint Venture on OML 29 don issue statement on dis mata.
Media contact for di company Ndiana Matthew on 9 November, 2021 say dem get report of oil spill from a non-producing well head for dia Santa Barbara South field for Nembe local goment area, Bayelsa State.
Matthew say di magnitude of di incident dey extremely high and dem never determine di cause of di spill.
Or di quantity of hydrocarbons wey leak as at di time of di discovery but say dem don deploy containment booms around di well head. E add.
Di statement say dem don report to di National Oil Spill Detection and Response Agency, Nigerian Upstream Regulatory Commission and National Petroleum Investment Services
E add say all of dem do joint investigative visit to di spill site wit oda stakeholders, including di community.
"Di JIV dey inconclusive because of difficulties with access due to high pressure of hydrocarbons for di Well head.
"Additionally, we abort immediate efforts to control di leak due to di high pressure wey dey comot from di well head.
So AITEO don mobilise full intervention team with Well control specialist and requirements.

Wia dis foto come from, Aiteo
AITEO bin get license from a consortium of oil majors headed by Royal Dutch Shell Plc in 2015.
Di sale price of $2.4 billion for di permit and a pipeline na di largest paid so far by Nigerian companies wey dey buy assets from international companies.
Oil spills or leak, particularly from pipelines, dey common inside Niger Delta area of Nigeria wey be Africa's largest oil producer.
Experts now dey ready to start di work of sealing di well so that di cause and scale of di leak go fiy dey determined, Idris Musa, director general of Nigeria's National Oil Spill Detection and Reponse Agency, tell Bloomberg tori pipo.















