Justice Mary Odili house raid: Police parade journalist, fake Chief Superintendent of Police, oda suspects for Abuja

Justice Mary Odili: Peter Odili wife Abuja home invasion, EFCC, DSS deny, Wike kick

Wia dis foto come from, Other

Published

Police say dem don arrest 14 pipo in connection with di siege on Justice Mary Odili apartment for Abuja, recently.

Na on 29, October wey tori comot say security operatives bin storm Justice Odili apartment for Abuja.

Di mata cause reactions sake of say Mary Odili na Justice of di supreme court and wife of former Rivers state Govnor, Peter Odili.

Some of di suspects according to police include one fake Chief Superintendent of Police, Lawrence Ajodo; one journalist with one of di national dailies, and one Islamic scholar.

Di Force Public Relations Officer, Frank Mba wey parade d suspects for Abuja on Thursday explai say dia arrest na as a result of fast investigation by di police.

At least ten more pesins wey dey linked to di incident including two military personnel don japa, di police tok-tok pesin tok.

Police dey brief press about wetin hapun on Thursday, 11, 2021

Wia dis foto come from, Nigeria police

Wetin we call dis foto, Police dey brief press about wetin hapun on Thursday, 11, 2021

Wetin more police tok

Police name di suspects as; Ajodo Lawrence 'm' (principal suspect), Michael Diete-Spiff 'm', Bar. Alex Onyekuru 'm', Bayero Lawal 'm', Bar. Igwe Ernest 'm', Aliyu Umar Ibrahim 'm', Maimuna Maishanu 'f', Ayodele Akindipe 'm', Yusuf Adamu 'm', Bashir Musa 'm', ASP Mohammed Yahaya 'm', Stanley Nkwazema 'm', Shehu Jibo 'm' and Abdullahi Adamu 'm', L/CPL Mike (other name unknown) 'm'.

Di statement from police say dem be members of a well-organized criminal gang wey involve individuals from different areas, professional background and social contacts to perfect dia criminal plot.

Membership of di syndicate include suspects with background for public service, business, law, journalism, banking, among odas.

Di night of di raid wen Rivers State Govnor Nyesom Wike arrive Justice Mary Odili domot following reports say security operatives storm di Supreme Court Judge home

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Di night of di raid wen Rivers State Govnor Nyesom Wike arrive Justice Mary Odili domot following reports say security operatives storm di Supreme Court Judge home

How e hapun

According to di police tori, "one Aliyu Umar Ibrahim, wey call imself whistle blower, afta one baseless and unverified informate wey im get from one Adamu Yusuf wey dey parade imsef as godson of Peter Odili, say plenti amount of money(foreign currencies) dey inside Justice Mary Odili house, begin di process to recover di money.

Dem come contact one Bashir Musa, wey be clerical staff for Central Bank of Nigeria(CBN) wey still call two oda pipo Shehu Jibo and Abdullahi Adamu.

Later, dem introduce di whistleblower to one Bayero Adamu wey fake imsef as Director for EFCC, im come cari di whistleblower introduce to oda pipo wey make up di gang until dem meet one Lawrence Ajodo wey fake say im be Chief Superintendent of Police and also di officer in- charge of one asset recovery panel for di Federal Ministry of Justice, wey no dey exist.

Di fake CSP cari two Assistant Superintendent of Police wit di help of one Ayodele Akindipe.

Di fake CSP also cari one journalist and two lawyers.Afta investigations, police say dem find out say:

  • Di suspects criminally trespass di house of Justice Mary Odili and dem no allow di suspects use di search warrant due to di lawful resistance from police officers wey dey on guard for her house.
  • Lawrence Ajodo na impostor and no be real police officer.
  • Di ghost accounts for local whistleblowers and Assets Tax Recovery Panel wey di suspects tok say dey operate under di Federal Ministry of Justice no dey exist.
  • Di signature of di Attorbey General of di Federal and Minister of Justice, Abubakar Malami wey dey di Identity card wey di suspects present na fake and na dem forge am.
  • Di search warrant wey dem get from magistrate court to use search Justice Mary Odili house, dem get am under false representation.
  • Dem also find out say no known security agency or federal goment give dem di go ahead .

Reactions to di raid

Di night of di raid wen Rivers State Govnor Nyesom Wike arrive Justice Mary Odili domot following reports say security operatives storm di Supreme Court Judge home

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Di night of di raid wen Rivers State Govnor Nyesom Wike arrive Justice Mary Odili domot following reports say security operatives storm di Supreme Court Judge home

Di Nigeria Bar Association (NBA) bin chook mouth for di mata wen e hapun say na 'unlawful siege' by security operatives on di house of dia colleague.

Di president of di NBA, Olumide Akpata SAN bin tok for inside one statement wey di association release say:

"In case law enforcement agencies neva learn dia lesson, events like dis na im dey reduce di independence of sacred democratic institutions like di Judiciary, undermine di rule of law for Nigeria and dey reduce pipo confidence in Nigeria..."

Akpata follow tok say im go lead delegation go see di minister of justice, Abubakar Malami and heads of security agencies to find true-true wetin really happen.

Rivers State Govnor Nyesom Wike togeda wit some close friends of di Odilis like Abiye Sekibo and Raymond Dokpesi visit di house to check on dem.

Meanwhile, Police bin no tok peem di time di mata burst on wetin dia 'operatives' go find for Justice Mary Odili domot. But dem don come out to clear di issue now.

Abubakar Malami, Nigeria Minister of Justice bin also deny involvement for Justice Mary Odili Abuja home invasion.

Malami say make dem count am out, and say im gatz clear di mata sake of di dimension wey di story don dey take.