You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
University of Abuja: 'How I escape afta gunmen invade UniAbuja Staff Quarters, kidnap eight pipo'
Relatives of di pipo wey armed men kidnap for University of Abuja Staff Quarters don dey beg security agencies make dem help rescue dia loved ones.
On Tuesday, 2nd November some gunmen bin storm di staff quarters of di University of Abuja for early morning and kidnap eight pipo.
Some of di relatives to di kidnap victim tell BBC Pidgin say dem still dey in shock over di incident.
Presently both authorities for University of Abuja, Gwagwalada Area Council Chairman and di FCT Commissioner of Police dey try rescue di victims.
'How I take escape from di gunmen'
One of di kidnap victims escape as di armed men dey carry pipo wey dem abduct from university of Abuja staff quarters.
Di victim follow BBC Pidgin tok say im manage to escape through one bush path as di gunmen dey carry dem dey go.
"I see one bush path as dem dey carry us dey go, I just hide and pass dia take escape."
E say di armed men burst enta dia house around 12:45AM and carry am, e papa wey be professor plus e younger broda before e manage run.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di victim add say di gunmen break enta like three houses and so far dem kidnap 8 pipo.
Meanwhile, anoda professor wey di gunmen kidnap two of im pikin say e neva see dis kain of thing before.
Di Professor say im bin pass through di oda door run comot from house wen di armed men invade e house and one of e pikin wey dem kidnap na 9 years old.
How Security Operative dey handle di incident
Police for Abuja confam di attack and say den don send security forces to search and rescue di victims plus arrest di bandits.
Di FCT Commissioner of Police, Babaji Sunday say di armed criminal invade di UNIABUJA Staff Quarters wey dey Giri area of Gwagwalada Council Area of di FCT
Oga Sunday say one combined team of police and personnel of di Nigerian army 176 guard battalion quickly run go di area to protect citizens.
" We deploy tactical and conventional officers to di University of Abuja both main and satellite campuses, staff quarters, oda university building to improve public safety," Sunday explain.
E add say di security operative dey work wit local pipo for di area to make say say dem rescue di victims.
Wetin oda residents tok
Residents say di gunmen invade di living quarters of di University for around 1:00 AM local time.
Di gunmen come overpower di University guards before dem break enta di teachers houses.
Some eye witness tell BBC Pidgin say about 50 bandits arrive di school around 12:00AM and start to dey shoot upandan plus move from house to house kidnapping pipo.
Wetin University of Abuja don tok
One statement for di Facebook page of di university of Abuja say four lecturers and dia children na im di invaders kidnap.
Di tok tok pesin for di university, Habib Yakoob say di whole incident dey traumatic for staff dem.
E say even at di moment now, e dey hard to confam di names of those wey dem kidnap but di school dey work togeda wit di police to ensure dia safe return.
Dis na di closest wey armed gangs, known locally as bandits, don reach for di capital.
Di university itsef dey opposite one military facility near di Abuja airport.
Recent security reports show say bandits don dey move closer to Abuja but security agencies neva announce any measures to contain dem.
Communities within di suburbs of di capital city don experience attacks for recent months.
Some villagers don fall victims to kidnappers. Many of dem get dia freedom afta dem allegedly pay ransom.