Paternity leave in Nigeria for men go be two weeks - FG

Papa and im ew born pikin inside hospital.

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Paternity leave fit help papa bond wella wit im new pikin
Published

Di Federal Executive Council wey Vice-President Yemi Osinbajo bin preside ova today don approve 14 day paternity leave for civil servants.

Na di head of civil service for di federation, Folasade Yemi-Esan tell dis one give tori pipo at di end of di weekly meeting.

Oga Yemi-Esan tok say di leave go dey calculated based on working days, not calendar days.

E say e dey important so new papa dem go fit bond with dia new borns or adopted pikin.

Howeva for Aaopted pikin dem, e go only dey available for men wey adopt pikin wey dey less dan four months.

Before for Nigeria, na states dey regulate the paternity leave for dia workers for 10 days.

Hiw Nigeria dey run paternity leave before?

For May 2018, Nigeria house of representatives bin reject bill wey suppose allow married men wey dey work for public and private sectors dem to go for leave.

One of di worries wey dem bin get na on top men wey get multiple wives dem.

A father and his daughter

Wia dis foto come from, Wayne Djokoto/Nappy.co

Wetin we call dis foto, Na around two states for di kontri get any kind of paternity leave for Nigeria

For 2014, Lagos State approve 10 days paternity leave for any male civil servant for di state with new pikin.

Oda kontris wey get paternity leave

Di International Labour Organization for report tok say paternity leave dey di national legislature of 79 kontris, 29 of which dey for Africa.

Tunisa bin get one day leave while Morocco and Tanzania dey give less dan one week.

Benin bin give up to ten days while Kenya dey give up to two weeks of paternity leave.