NDLEA arrest Nigerian drug lord with N8 billion worth cocaine

Published

Di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don arrest one drug lord wey dem accuse of carrying cocaine wey worth N8 billion for street value.

Di agency for inside statement say dem arrest di Brazil-based drug kingpin, Ejiofor Felix Enwereaku wey dem allege say lead di syndicate for di airport on Friday, May 14, 2021

Dem explain say di suspect dey arrested on top accuse say e import 27.95kg of cocaine and e use one organised criminal gang, wey be expert in tagging and planting drugs for innocent travellers' luggage.

Based on intelligence, narcotic agents for di Muritala Mohammed International Airport bin seize di bag wen e land Lagos from GRU, Brazil, via Addis Ababa, Ethiopia.

Di NDLEA in recent months don make some big arrests and confiscation in di last few months.

Brig. General (rtd) Mohamed Buba Marwa wey resume duty as di Chairman of di agency wey dey fight drug barons and oda drug abuses inside Nigeria for January 2021 bin promise say di NDLEA under im watch go work to reduce di number of drug addicts and promise to improve di lives of di agency staff.

Dis na some of di ogbonge operations di agency don carry out in di last few months.

MAY

Di most recent na di 36 blocks of cocaine wey weigh 27.95 kilogrammes and cost over N8 billion for street value wey NDLEA bin seize for di Murtala Muhammed International Airport, MMIA, Ikeja, Lagos recently.

Still for May, NDLEA for inside anoda ogbonge operation bin seize 4,996,200 capsules of tramadol wey weigh 2,498.2 kilogrammes for di Onne port, Port Harcourt, Rivers state.

Di seizure of di illegal drug wey dey packaged inside 1,387 cartons na during joint examination by NDLEA operatives and Customs personnel.

Operatives of di NDLEA also raid some eateries for Jos, Plateau state wia dem gbab freshly baked cakes wey dem use cannabis sativa bake.

APRIL

For di Murtala Muhammed International Airport, Lagos and di Mallam Aminu Kano International Airport, Kano Operatives of di NDLEA bin seize consignments of heroin wit street value wey pass N10 billion.

Di agency arrest wanted suspected major drug supplier Chibuike Apolos wit over 100kg cocaine, cannabis.

One Drug trafficker also shit 97 wraps of cocaine afta dem gbab am for Lagos airport.

Di agency catch two drug traffickers wit N264m cocaine for Abuja.

MARCH

For March, NDLEA seize over N2bn worth of illicit drugs for Lagos airport and dem arrest three suspected traffickers.

Di agency also destroy 95 hectares of cannabis farms for Ondo state.

126 Nigerians across 14 states for Nigeria also dey sentenced to prison sake of offences wey relate to drug trafficking between January and February 2021.

FEBRUARY

NDLEA bin seize one container load of Tramadol for Apapa seaport Lagos and dem arrest 90 pipo join.

Di drug enforcement agency also seizes 40 parcels of cocaine wey worth over N32bn for Lagos Tincan Port

Dem discover one Cannabis Warehouse in Rivers State and seize 1,292 kilograms of illicit drug for Ondo forest.