You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
AstraZeneca Covid-19 vaccine: See why Nigeria fit stop to dey give vaccines to pipo
Authorities for Nigeria say dem go stop to dey give di Oxford-AstraZeneca COVID-19 vaccine after dem don use half of di dose wey dey di kontri.
Di health minister tell tori pipo say since di kontri no sure when di second batch of di vaccine go land, dem need to keep di remaining half for those wey don already collect di first dose.4
AstraZeneca vaccine need two dose to dey effective for pesin body.
- https://bbc.com.im/pidgin/tori-56228118%3C/a%3E%3C/li%3E%3Cli role="listitem" class="css-1maxgwy">https://bbc.com.im/pidgin/tori-56636694%3C/a%3E%3C/li%3E%3C/ul%3E%3C/div%3E%3Cdiv dir="ltr" class="css-1k9op6x e17x9cvu0">
Di goment don already say di vaccination program go first favour frontline health workers and those wey dey vulnerable, like old pipo.
End of Di one wey oda users dey read well well
All dis dey come as di kontri don begin do clinical trials for two covid-19 vaccines wey dia own scientists don create.
As at di time of dis report, di kontri don record 162,000 cases of COVID-19 and more than 2,031 people don die from di virus.