Political parties neva release list of successful candidates from dia primaries five days after

Published
Read am in 4 mins

Na about two weeks now wey all political parties for Nigeria conclude di primaries for aspirants wey wan contest for different positions for di 2027 general elections.

Even though di aspirants and dia followers including party pipo know who and who win di primaries, di political parties neva officially bring out list of dia candidates.

One of di parties na di ruling All Progressives Congress (APC) wey officially tok say dem neva release list of candidates for di party.

For statement wey dem release on 4 June, 2026, wey National Publicity Secretary, Felix Morka sign, di party tok say di "Concluded list of APC Senatorial Candidates So Far" wey dey currently circulate for social media and some online platforms "na fake and e no come from dem".

APC tell dia members and stakeholders make dem disregard di publication and evritin about am.

"Di Party dey emphasise say only di National Working Committee (NWC) of di APC, acting thru dia duly authorized channels of communication, dey empowered to announce di list of candidates wey emerge from dia primary elections and oda constitutionally prescribed processes."

APC also cut warning for pipo wey dey circulate tori wey dem neva verify wey fit cause confusion and mislead di public.

No be only APC wey neva release official list of candidates,oda parties too neva bring out official list of Senatorial and House of Representatives candidates.

Wetin wey see na announcements and handing of flags to presidential candidates.

Like incumbent President Bola Tinubu for APC, Peter Obi - NDC, Atiku Abubakar - ADC, Goodluck Jonathan - PDP (faction), Chibuzor Okereke - Labour Party, Adewole Adebayo - SDP.

Anoda tin wey we sabi na state chairmen wey bin announce di aspirants wey win di primaries for dia various senatorial district primaries.

NDC Primaries and di alleged kasala wey happun

While we dey tok say some parties neva release official names of candidates wey go be dia flagbearers for di 2027 general elections, di mata wey dey inside di tear rubber Nigeria Democratic Congress (NDC) party get anoda level.

Controversy plenti for di party sake of di tins wey happun for di primaries wey dem conduct on May 30, 2026.

One of di major allegations na di one wey Nigerian activist Aisha Yesufu claim say mago-mago happun for di Federal Capital Territory Senatorial District primary.

Anoda popular figure for NDC wey be Nollywood actor Emeka Ike bin also allege say mago-mago happun for di House of Representative primaries for Amac/Bwari Federal Constituency for Abuja wey happun on 29 May.

Im claim say dem bin no allow some pipo vote plus oda tins..

Senatorial and House of Representative aspirants for NDC for Delta state too bin dey para.

Inec cancel primaries wey happun afta May 30

Di Independent National Electoral Commission (Inec) don cut warning for political parties say any primary election wey dem do outside May 30 deadline no go stand unless higher court overturn di earlier Federal High Court judgment on di mata.

Di Inec National Commissioner Chairman of di Information and Voter Education Committee, Mohammed Kudu Haruna tell local tori pipo Punch.

Im advice political parties to continue to follow wetin dey inside di 2025 Electoral Act 2026 pending wen di Court of Appeal go determination di appeal wey Inec carry go meet dem.

Haruna stated: "Obviously, for now, any primary wey happun outside Inec May 30 deadline go dey invalid unless di Court of Appeal overturn di Federal High Court judgment for Inec appeal against di ruling say di timetable breach di Electoral Act 2026 for some of di provisions."

Federal High Court for Abuja wey Justice Mohammed Umar, bin preside over, give judgment, wey bin nullify saome part of Inec electoral guidelines and timetable wey inec also bring out wey dem go use conduct di 2027 general elections.

Justice Omotosho, for di judgement inside di suit wey di Social Democratic Party file tok say Inec dey constitutionally empowered to issue election timetables and schedules of activities for elections.

Even though di commission get di powers, Inec suppose use am within di timelines wey di Electoral Act, 2026 prescribe.

Dis dey come as di African Democratic Congress primary election appeals committee for Kaduna State order rerun elections for plenti federal and state constituencies sake of petitions wey pipo bring from di party primaries.

Some political parties neva still tok wetin di problem be but in di coming days evritin go dey clear.