You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Bunny Wailer: Jamaican Reggae legend wey play with Bob Marley don die
One of reggae most important voices, Bunny Wailer, don die for di age of 73.
Di musician wey come from Kingston, Jamaica, na founding member of The Wailers, wey go on to find international fame with Bob Marley.
Manager Maxine Stowe, and Jamaica Culture Minister, Olivia Grange na dem confam di death of Bunny Wailer.
Di cause of death no dey known, but e bin dey for hospital since e get stroke for July 2020.
Bunny Wailer na one of Bob Marley childhood friends, e work on im first two albums, Catch A Fire and Burnin', before e go solo for 1974.
E go continue with e singing to win three Grammys and dey give am Jamaica Order Of Merit for 2017.
Bunny Wailer wey e real name na Neville O'Riley Livingston, na di last surviving member of The Wailers, afta Bob Marley die from cancer for 1981, and Peter Tosh murder during one robbery in 1987.