You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Maina: Former Pension Reform Taskforce boss collapse for Abuja court
Former Chairman of Nigeria Pension Reform Taskforce Team, Abdulrasheed Maina on Thursday collapse for court.
Di former pension boss collapse wen e lawyer, Anayo Adibe bin dey address di court.
Nigeria government dey investigate Maina on 12-count charge of fraud and money laundering.
On 3 December 2020, one witness for di trial of Abdulrasheed Maina bin tell Federal High Court for Abuja say di former pension oga bin buy properti for Dubai, US and one oda properti for Jabi, Abuja wey worth $2 million.
Di witness wey be EFCC detective reveal say anoda witness Adamu Modibbo wey bin testify about di Jabi, Abuja properti bin allegedly die of Covid-19 afta im statement to di Commission. She add say dem bin collect about 32 documents, hard discs and flash drives wey relate to di properties wey dem link to Maina and im family.
According to di witness wey EFCC no name, "Investigation show say Maina company, Northrich Company get over 50 cars wey dem dey use for transportation business and im get villa for one High Ground area for Dubai.
"Im wife Laila Abdurrasheed also get cleaning service wey dem call Spotless and Flawless. We also recover pay slips during our investigate".
Di judge wey dey try di case Justice Abang bin move di mata go December 4 for continuation.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dem dey do im trial witout im physical presence unto say, e jump bail and no gree show imsef for trial.
But on Wednesday December 2, Nigeria authorities announce say dem gbab Maina for Niger Republic wen im dey try run comot for Nigeria before EFCC bring am come back to di kontri on Thursday.
Na since 2012 Maina don dey face corruption accuse sotay im enta EFCC wanted list for 2015.