You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Ajah news today: See wetin we know about shootings for Ajah area of Laggos
Nigeria police don confirm say dem dey Ajah area for Lagos dey do operation for blackspots for di area.
Muyiwa Adejobi wey tok tok pesin for Lagos police command tell BBC Pidgin say dem don arrest some suspects and recover plenti items wey jaguda pipo steal.
Tori comot for social media on Sunday say jaguda pipo dey clash wit police for Ajah, say police dey arrest pipo anyhow for di area.
We receive reports say pipo dey run upandan for Ajah on Sunday morning as viral videos capture sound of gunshot for di area.
Nicky Ofondu wey dey live for di area tell BBC Pidgin say: "I notice serious dis morning. Since five days if I close from work dey reach my area for Ajah, I go begin fear, di area go dey look like wia pipo run from, you go dey hear tori of wia dem rub pipo".
She add say "all dis tins start after di EndSARS matter wia Nigerians enta street to protest against police brutality, in fact I dey tell my husband say we go pack comot from di area if di situation continue like that".
Wetin really happun for Ajah
On Thursday, jaguda pipo attack and rub one bullion van wey carri moni and kill one pesin injure anoda gateman for di operation wey happun for Ado road for Ajah.
Doctor wey treat di gateman wey im name na Daniel Ali confirm to BBC Pidgin say di gate man don finally die after dem do operation for im bodi.
End of Di one wey oda users dey read well well
Plenti jaguda pipo start to dey cause trouble for some flash points around Lagos after di EndSARS protest, as di state experience destruction of public and private properties.
On Saturday, Nigeria army tell Lagos state judicial panel wey dey touchlight EndSARS matter say na jaguda pipo rub di bullion van as dem don dey gingered to operate sake of wetin happun to police during the protest.