You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'Strait of Hormuz go dey open to all' - Trump say dem go sign US-Iran deal on Sunday
Deal to end di fight between di US and Iran dey "scheduled to get signed" on Sunday, according to President Donald Trump.
US President Trump say di deal go mean no nuclear weapon, but Iran don cast doubt on di timing.
For im post on social media, Trump also say di Strait of Hormuz wey be key shipping route for di world oil and liquefied natural gas, go dey "open to all" sake of di deal.
Pakistan wey be key mediator, also say finalisation of di deal dey expected within 24 hours and dem dey "prepare for di electronic signing".
Bifor Trump comments, Iranian Foreign Ministry spokesman Esmaeil Baghaei express caution say dem go wait for di exact date of di signing.
"We go gatz wait and see about di exact date of di signing of di memorandum of understanding, although e fit no be tomorrow."
For Saturday post on Truth Social, Trump write: "Di Deal dey scheduled to get signed tomorrow (Sunday), and immediately afta e dey, di Hormuz Strait dey OPEN TO ALL."
Di US president also stress say di deal go be "A WALL TO NO NUCLEAR WEAPON!"
As e dey refer to Iran enriched uranium stockpiles, Trump add say "at di appropriate time, wen all isdeycalm, we go go in and get di Nuclear Dust", say dem go later downblend and destroy am
For decades, Iran dey accused by Western kontris of trying to build nuclear weapon.
Dem deny di accusations say dia programme na for peaceful purposes - to generate electricity and for research purposes.
Trump also warn say if tins no go "work out quickly, easily and smoothly", Washington get "di ultimate alternative, hopefully neva to dey used again!"
Earlier on Saturday, Pakistani Prime Minister Shehbaz Sharif say dat "we dey closer to peace deal dan eva bifor".
"Wit finalisation likely expected for di next 24 hours, Pakistan dey prepare for di electronic signing of di peace deal immediately afta followed by technical level tok next week," Sharif write for X.
On Friday, Iran Foreign Minister Seyed Abbas Araghchi also say deal wit di US dey close.
Di agreement also dey expected to end di conflict between Israel and Hezbollah for Lebanon, e say.
Araghchi tell Iran state TV say di deal include reopening di Strait of Hormuz and also di lifting of US blockade of Iranian ports.
Howeva, e say tok on Iran nuclear programme go begin later.
US officials confam some of di details of di agreement, saying economic benefits for Iran go depend on if Tehran meet dia obligations.
Previous reports from di US suggest say Lebanon fit no dey part of di dealas Iran dey reportedly insist.
Di war begin wit US and Israeli strikes across Iran on 28 February, prompting Iran to attack Israel and US-allied states for di Gulf - as well as effectively closing di Strait of Hormuz.