Palliative: Gwagwalada warehouse for Abuja dey under attack

Gwagwalada warehouse for Abuja dey under attack

Wia dis foto come from, Screenshot

Published

Thousands of pipo don break into warehouse for Gwagwalada area of Abuja.

Di warehouse belong to di FCT authority and e dey located around di Local Education Authority.

Both old men plus women and pikin dem join as dem begin load bags of rice, noodles, salt. Sugar and oda items away.

Palliative: Gwagwalada warehouse for Abuja dey under attack

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Inside di warehouse, as pipo dey loot.

Di looting for Abuja FCT (Nigeria political capital) start since on Sunday.

Di jaguda pipo alias hoodlums dem bin attack di Idu Industrial Warehouse and later dis morning dem begin loot di one for Gwagwalada.