Lagos Gov go support business wey jaguda pipo tiff, spoil during curfew

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Lagos State goment don announce plan to epp pipo for di state wey dia business spoil during di curfew wey di goment impose recently.
Di Lagos State Employment Trust Fund (LSETF) wey be goment agency dem set up to torchlight unemployment, na im dey behind di programme.
State gov Babajide Sanwo-Olu bin order 24-hour curfew on Tuesday 20 October hours before di 'Lekki shootings' wia soldiers open fire ontop unarmed protesters.
Di curfew later turn violent as jaguda pipo begin tiff from and burn down businesses - from big supermarkets to small shops.
LSETF Friday night post from dia official Twitter account say: "LSETF dey here to epp".
How to get di LSETF business support
•First, di condition na say di business must dey based in Lagos
•Also from di announcement, na only business wey dey affected during curfew (wey begin 20 Oct.) dem go attend to
•Business owners wey want epp must fill one form
End of Di one wey oda users dey read well well
•Based on di form we torchlight, pipo go need submit tins like foto of di business damage, how much you reason say you lose and CAC registration number (although dis last one no dey compulsory).
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post













