Chacha Eke: Di Nollywood actress announce her pregnancy as she speak about her 'Bipolar Disorder' again

Chacha Eke Faani

Wia dis foto come from, chachaekefaani Instagram

Wetin we call dis foto, Chacha announce her pregnancy for video for social media
Published
Read am in 1 mins

Nollywood actress Chacha Eke dey expect her fourth pikin with her husband Austin Fanni.

Chacha announce her pregnancy for video for social media on Monday October 12, just days afta she tok say she get Bipolar disorder and reveal say she dey comot her marriage .

For di video di actress say "every time I dey pregnant something inside me dey erupt". na wetin she tok.

She add say "e dey make me do crazy tins, think crazy and behave crazy".

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

She say she don suffer different episodes ova di years and she no bin know wetin dey do her wey make her feel different from inside until doctors diagnosis her say she get Bioplar disorder.

Di actress wey wear orange top for di video put one hand ontop her baby bump and tell her 2.3 million followers say she love her life.

Chacha and her husband Austin Fanni marry for 2013 and dem get three pikin. Dis year di couple celebrate dia seventh wedding anniversary.

Di video don get ova 100, 000 views for her Instagram page.