You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
National Youth Day: Nigeria join Ghana, Cameroon to get day to celebrate young pipo
President Muhammadu Buhari don set aside 1 November as National Youth Day for Nigeria, to follow Cameroon, South Africa odas.
Di kontri minister of youth and sports development Sunday Dare comot to announce say Oga Buhari approve di annual celebration inside di Federal Executive Council meeting wey happun on Wednesday.
"Again di President demonstrate im commitment to support policies wey go benefit youths, Thank You," Oga Dare bin write inside wey be like appreciation tweet.
Nigeria don join oda kontris for di world, including Cameroon, Ghana, Zimbabwe, to get national youth day.
Wetin dey happun on national youth day?
For most kontries, di day na for youths to comot and do parade or go popular city centres to sing songs and jolly demsef.
Although recently, for some kontris youth day na opportunity to raise awareness about mata wey dey worry young pipo.
E no dey clear if Nigeria national youth day go be public holiday for di kontri or not.