Majek Fashek US burial happun on Friday, Nigeria memorial to follow next year

Wia dis foto come from, Getty Images
Fans of di 'Rainmaker', Nigerian music legend Majek Fashek, fit say dia final bye-bye to am, as im burial ceremony don hold for United States.
Fashek wey im real name na Majekodunmi Fasheke receive 'quiet ceremony' on 21 August, according to wetin di musician manager Uzoma Omenka, tell di BBC.
Omenka thank all fans and explain say di reason why dem bury am for US na di coronavirus pandemic, although e no tok pass dis one.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Omenka promise say dem go make sure say "befitting memorial" go happun in Nigeria - wia dem born Majek - next year.
Di Nigerian reggae performer, wey dey popular for im hit song like Send Down the Rain and So Long for Too Long, die for im sleep for New York at age of 57.

Dis article contain content wey Google YouTube provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Google YouTube cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of YouTube post
He also write di song Free Africa, Free Mandela, wia im call for di release of Nelson Mandela inside apartheid South Africa.
As sign of how im blow ontop international scene, for 1992 on di David Letterman chat show on US television, he sing So Long for Too Long from di album Spirit of Love.








