India plane crash: Air India Express jet for Kerala wey break into two inside Calicut airport kill ova 17 pipo
One Air India Express plane wit 191 pipo on board don crash for one airport for di southern state of Kerala, kill at least 17 pipo, officials tok.
Di aircraft, wey dey come from Dubai, run comot di runway for Calicut airport afta im land, reports tok.
Rescue operations dey under way and emergency services dey di scene.
Prime Minister Narendra Modi say im dey "pained by di plane accident".
MK Raghavan, one lawmaker from Calicut, tell di BBC say at least 16 pipo die for di crash.
Dem don comot most pipo wey dey on board di Boeing 737 jet, dem carry atleast 35 of dem wey wunjure go hospital, authorities tok.

Wia dis foto come from, Reuters
Di airline say na 184 passengers dey onboard plus 10 children, and six crew members, including two pilots, on board flight IX-1344 wen di plane crash.
Goment bin dey use di flight to repatriate Indians wey dey stranded abroad during di coronavirus crisis.
End of Di one wey oda users dey read well well
Di Directorate General of Civil Aviation (DGCA) say di plane fall into one valley and break into two two afta e run comot from di end of di runway. Pictures from Indian media show say di aircraft break into two.
"Distressed to learn about di tragic accident of Air India Express aircraft for Kozhikode, Kerala. I don order NDRF [National Disaster Response Force] to reach di site sharperly and assist wit di rescue operations," UHome Minister Amit Shah tweet.

Wia dis foto come from, Kaviyoor Santosh BNI
Di incident happun around 19:00 local time (14:30 BTS)as heavy rainfall dey for di region.
For May 2010, 158 pipo die wen one Air India Express flight run pass Mangalore airport runway and crash.
We go dey update una as we gada more informate













