You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nipost license fee: Three goment policies wey vex small business owners for Nigeria
Nigerians still dey react to di increase of license fee for courier services wey di Nigerian Postal Service (NIPOST) bin propose.
Nipost bin propose make companies wey dey provide international courier services like DHL, UPS and FEDEX, dey pay N20m for new licence and N8m evri year for renewal.
While companies wey dey offer delivery services inside di kontri go pay N10m for new license and N4m yearly for renewal. Companies wey dey do delivery service within states go pay N2m and N800,000 for renewal.
Nipost claim say di new regulations wey dem propose na to protect genuine courier and logistics operators and send out pipo wey no dey registered.
But di minister of Communication and Digital Economy, Isa Pantami don react say di increase no dey part of di regulation wey im approve for di agency on Friday, July 24.
Di suggestion cause anger from some kontri pipo.
Di Nipost call bin make some kontri pipo vex as e no be di first time wey goment dey do dis kain policy wey dey choke business owners for di kontri.
Five percent VAT ontop online purchase
For May 2019, Nigeria Federal Inland Revenue Service say dem go soon begin collect Value Added Tax (VAT) ontop business wey pipo dey do for internet.
End of Di one wey oda users dey read well well
Kontri pipo bin hala afta goment introduce five percent VAT ontop tins wey pipo dey buy online.
Many bin complain say di tax fit kill e-commerce and cashless policy wey still dey gain grounds for Nigeria.
POS stamp duty
For September 17, 2019, di Central Bank of Nigeria bin release circular of stamp duty fee of N50 ontop evri transaction wey business pipo go dey anytime wey customer use dia POS machine to pay for market.
Stamp duty na tax on financial transactions and official documents like receipt, cheques and marriage license.
Later for November, 2019, goment change di policy from N50 stamp duty fee ontop payment wey dey above N1,000 to payments wey dey above N10,000.
Value Added Tax Act
For September 22, 2019, Nigeria Senate bin pass finance bill wey go see value-added tax increase from 5 percent to 7.5 percent.
Some sabi pipo bin tell BBC Pidgin say di bill wey di Senate don approve, go affect Nigerians pocket well-well as price of goods and service go increase and transport too go dey expensive.