You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
US consulate: China Chengdu, Houston consul eviction cold war - See How US vs China diplomatic 'war' start and wetin dey cause am
China don order di Consulate General of di United States, Chengdu to cose di US consulate for di south-western city of Chengdu, inside do-me-i-do-you kasala di two kontris.
China say di move na "necessary response" to di US, wey order China to close im consulate for Houston earlier dis week.
Secretary of State Mike Pompeo say di US make di decision sake of say China dey "tiff" intellectual property.
Tensions don dey rise between di US and China ova plenti key issues.
President Donald Trump administration don dey clash plenti times wit Beijing ontop trade and di coronavirus pandemic, plus di new security law wey China impose for Hong Kong.
Dis move from China dey came hours afta Oga Pompeo strong im tone inside one speech on Thursday for di library of former President Richard Nixon, whose 1972 China visit heralded a period of improved relations.
"Today, China dey become more authoritarian at home, and more aggressive for dia hostility to freedom for oda place," Oga Pompeo tok.
"Di free world must triumph over dis new tyranny."
End of Di one wey oda users dey read well well
Wetin China don tok?
China foreign ministry say di closure "follow law and na necessary response to di unreasonable actions wey di United States take".
"Di current situation between China and di United States na something wey China no wan see, and di US go bear all di responsibility for dat."
China don give di US till Monday to close di consulate for Chengdu, according to di editor of China Global Times.
Di mission, wey dem establish for 1985, wey currently get more than 200 staff - 150 of dem na local staff- dem see say am say e dey important because e dey allow di US to gada informate on di region of Tibet,
And for di region of Tibet, di pressure for independence don dey increase.
Wit im industry and growing services sector, US dey see Chengdu say e dey provide opportunities for exports of agricultural products, cars and machinery.
Why di US order make dem close Chinese consulate?
On Tuesday, diUS goment order China to close im consulate for Houston, Texas, by Friday.
Di move come as dem catch some unidentified individuals dey feem burning paper wey dey inside dustbin for di courtyard of di building.
Oga Pompeo accuse China say dem dey tiff "no be only American intellectual property... but European intellectual property too... wey cost hundreds of thousands of jobs".
"We dey set out clear expectations for how di Chinese Communist Party go behave. And wen dem no fit, we go take actions," he tok.
Di Chinese consulate for Houston na one of five for di US, along wit di embassy for Washington DC. E no dey clear why dem single am out.
China foreign ministry tok-tok pesin say di reason wey di US give to close dia consulate dey "no follow".
Hua Chunying ask di US to reverse di "erroneous decision", or China go "react wit firm countermeasures".
For one further US move, dem charge four Chinese nationals wit visa fraud say dem lie about dia membership of China armed forces - three of dem dey under arrest while di FBI dey seek to arrest di fourth pesin, wey dem tok say e dey for China San Francisco consulate.
Why tension dey between China and diUS?
Plenti tins dey at play. First, US officials don blame China for di global spread of Covid-19. President Trump don accuse say na for Chinese laboratory dem create di virus, even though im own intelligence officer say di disease "no be manmade or genetically modified".
Di US and China don also dey fro one tariff war since 2018.
Oga Trump don long accuse China of unfair trading practices and intellectual property theft, but for Beijing dem believe say di US dey try to stop dia rise as a global economic power.
Di US don also impose sanctions on Chinese politicians say dem dey responsible for human rights violations against Muslim minorities for Xinjiang. Dem also accuse China is accused of mass detentions, religious persecution and forced sterilisation of Uighurs and odas.
Beijing deny all di accuse and dem don accuse di US say dem dey "interfere too much" for dia domestic affairs.