You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Fertility rate crash: Study predict global drop in childbirth rate as Nigeria rise to second most populous by 2100
Nigeria go become di second biggest kontri for di world, with population wey go nearly reach 800 million. Na only India go pass Nigeria for population.
According to di new Lancet study, di population of sub-Saharan Africa dey expected to triple in size to more than three billion pipo by 2100.
Also, dem predict say Nigeria go get one of di largest pipo for working age in di world by 2100 and di economy go grow well well.
But di quick rise in population go make infrastructure and social structures suffer, and Nigerian officials comot to tok about how to slow down population growth.
For one 2018 interview wit di BBC, Finance Minister Zainab Ahmed tok say need dey to sidon tok about how pipo dey born for Nigeria - because na one of highest for di world.
"We get plenty families wey no fit feed di pikin dem get, not to tok about better healthcare or even to give dem good quality education, so we need to tok about dis tins," she tok.
What about oda kontris around di world?
For many kontris around di world, na opposite dey happun as sabi pipo say fertility rate (di average number of pikin women dey born) go begin drop.
And di world no ready for di global drop of newborn pikin as e go get big effect ontop our society, sabi pipo don hala.
End of Di one wey oda users dey read well well
Fertility rate wey dey reduce mean say nearly every kontri fit see dia population reduce by di end of di century.
And 23 nations - including Spain and Japan - go see dia population reduce to half by 2100.
Kontris go also begin get plenty old pipo.
Wetin dey happun?
Fertility rate - wey be di average number of pikin women dey born - don begin reduce.
If di number fall below 2.1, den di size of population go begin drop.
For 1950, women dey born average of 4.7 children in dia lifetime.
Researchers for Institute for Health Metrics and Evaluation wey dey University of Washington show di global fertility rate almost drop to half to 2.4 for 2017 - and dia study, wey Lancet publish dey torchlight say e go still reduce to 1.7 by 2100.
Why fertility rate dey reduce?
Sperm counts or di usual things na wetin pipo get for mind wen dem think of fertility.
Instead, di drop na because more women dey work and gain education, and because of contraception wey dey make women born less.