You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria government dey investigate Abdulaziz Yari and Ahmadu Fintiri over FAAN accuse say dem break airport Covid-19 guidelines
Di Aviation minister of Nigeria Hadi Sirika say goment go prosecute anybody including VIPS wey break di Covid-19 protocols and guidelines for airports for Nigeria.
Sirika wey tok during di daily Presidential Taskforce on Covid-19 briefing say dem no go tolerate dat kain behaviour from any passenger wey behave anyhow including VIP.
Sirika also confirm say investigation dey on ontop report of say some VIPS, di former governor of Zamfara Abdulaziz Yari and Adamawa state govnor Ahmadu Fintiri break protocols.
"Dis alleged unruly govnor include di former Govnor of Zamfara state, Abdulaziz Yari whom I speak with yesterday and di current govnor of Adamawa, Ahmadu Fintiri and Chief Nduka Ogbagbuna here for Abuja, we dey investigate di mata.
"If we find say na true, we go do di needful and if na lie, we go apologise", im tok.
Dis tok from Sirika dey come afta di Federal Airports Authority of Nigeria accuse Yari and Fintiri say dem break Covid-19 rules.
Meanwhile di former governor of Zamfara State Yari tok say wetin FAAN tok say e push one of dia staff and no gree follow Covid 19 guidelines for Aminu Kano airport for Nigeira na big lie.
Inside statement wey media consultant to Yari Mayowa Oluwabiyi send to BBC, di govnor add say e dey demand make FAAN apologise to am over dia release and as a responsible citizen wey im be e no fit do wetin dem tok.
End of Di one wey oda users dey read well well
"Wetin FAAN dey tok on dis mata no be true, as a responsible citizen i go through all di checks for Aminu Kano airport and I no fight or push anybody as dem yan."
FAAN bin tok say di former Nigerian govnors chairmo wey travel through Aminu Kano airport apart from say e no gree to checks even use hand push away staff wey dey try disinfect im bags as per Covid-19 guidelines.
Second pesin wey FAAN accuse na govnor Ahmadu Fintiri of Adamawa state wey dey for northeastern Nigeria, according to di agency di govnor and im pipo no gree make portharcourt airport staff check dem when dem land.
Dem add say di govnor and im pipo no also gree sanitise dia hands and also di bags wey dem carry.
Solomon Kumangar, Director General Media to govnor Fintiri tell BBC say wetin FAAN tok no be true.
"Our govnor na responsible pesin wey no go do wetin dem tok. E allow recognised staff take im temperature and pipo wey follow am too."
"E get some oda boys wey come wey we no fit identify so e dey okay say govnor pipo no go allow dem get too close but we follow all di rules wey FAAN set." Im tok.