Ghana EC start special voter registration exercise give 'Akufo-Addo graduates' - See why dis dey stir debate

Published
Read am in 3 mins

Electoral Commission of Ghana say dem go start two-day special voter registration exercise for students across de country.

Dis move dey stir debate among some Ghanaians who dey question de motive of govment for registering these students wey dem dey call 'Akufo-Addo graduates.'

Acting Director of Public Affairs Sylvia Annoh talk for statement inside say "all qualified Senior High School students wey chop 18 and above for try present dema body for at these registration centres within dema schools with either dema passport or Ghana Identification Card."

But de opposition National Democratic Congress (NDC) say dis move wey EC wan do be illegal.

Deputy General Secretary of NDC, Peter Boamah Otokunor argue say "dis be bizarre... No political party get list of schools dem go use for de exercise."

NDC Officials believe say dis once dem no gazette de schools as centres, de move by EC be illegal, but EC explain say dem go attach de students to polling stations wey dey close to de schools, no be say dem dey create new ones.

Who be Akufo-Addo graduates?

• Govment of Ghana start Free Senior High School (Free SHS) policy in 2017 to provide access to all Ghanaian students

• De first batch of graduates under dis policy go complete SHS dis year

• Prez Akufo-Addo coin de term 'Akufo-Addo graduates' last month when ease Covid-19 restrictions by opening schools give just final year students to write dema WEAC exams

• 'Akufo-Addo graduates' be de first SHS students for Ghana wey no pay fees throughout dema three years secondary education

Why registration of Akufo-Addo graduate dey stir debate

• Some Ghanaians dey question why govment dey expose dis students to Covid-19 despite de risk.

• Critics say govment dey take advantage of de free education to get votes from de students

• De special student registration exercise for SHS students dey feed into dis suspicion

• Those opposed to dis move feel e be wrong to expose de students to Covid-19 just so dem go register and vote give govment

Some Ghanaians for social media express dema reservations about de move which dem say no be sheda be cool.