Lazarus Chakwera: Malawi president reply critics wey say im appoint wife, husband plus brother and sister as ministers

Wia dis foto come from, Reuters
Malawi new President Lazarus Chakwera don respond to criticisms say im dey do padi-padi goment say im get good reasons to select im cabinet di way im do.
Some pipo bin provoke say afta im appoint family members as ministers for im cabinet.
Pipo begin react afta di president appoint im former running mate for di 2019 elections, Sidik Mia as minister for transport, im wife Abida Mia as di deputy minister for lands.
Di president also appoint Kenny Kadodo as di new labour minister and im sister Khumbizie Kandodo as di health minister.
Oga Lazarus appoint businessman Gospel Kazako as information minister and im sister-in-law Agnes Nkhoma as di deputy agriculture minister.
But di president don respond say pipo wey dey criticise fit get point but di pipo im appoint be accomplished politicians in dia own right.
Mr Chakwera say di test no go be who di ministers be but weda dem go deliver.
Dis mata bin no sweet di belle of some Malawians as dem drag di presido for social media say e do di same thing im accuse di former presido Presido Mutharika on top.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, JACOB NANKHONYA
Di presido bin attack im predecessor say e pack im village pipo, pipo from where e come from for im cabinet.
Dem tok say more dan 70% of di pipo di president appoint na pipo from di central region, area where im get mouth politically.
Dem argue say with dis new cabinet, dem no dey expect much from di goment.
One Malawian Alfie Saweta tweet say " I no go lie, I dey vex on top dis cabinet list. Maybe our expectations too high. Husband, wife and wife cousin all inside one cabinet, na wa..."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Anoda tweeter user tok Hugo Mlewa say "Im for avoid family relations for im cabinet, son of, husband of, brother of..."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Lazarus Chakwera bin recently take oath of office alias swear in on afta e win historic election as president of Malawi.











