Nigeria coronavirus update: Goment seize UK aircraft wey conduct 'illegal commercial flight'

Keyframe #7
Published
Read am in 1 mins

Nigeria don seize one UK aircraft dem say conduct illegal commercial flights for di kontri.

Di kontri Aviation Minister, Hadi Sirika tok say di company, Flair Aviation bin get approval for humanitarian operations but dem catch dem dey do anoda tin, commercial flights.

"Dis na wicked tin! We don impound di aircraft, we dey question di crew. Dem go get di maximum penalty. Dis na di wrong time to try us!" Di statement ontop Hadi Sirika twitter handle tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Sirika tell BBC say dem hide identity take gbab Flair Aviation wey bin dey run commercial flights for Nigeria despite di ban wey dey in place.

According to di minister, some of im pipo use anoda identity to request to travel commercial with Flair aviation and dem confam say nowhere wey dem no dey go.

"Afta we get report of wetin dem dey do, some of our pipo hide dia identity come send request to Flair Aviation say dem wan travel and from dia di company say nowhere wey dem no dey go London, Lagos, Uyo."

We don gbab the plane and di staff go dey with our security pipo for sometime as we continue to investigate how dis kain tin take happun."

"Di painful part be say dis pipo beg us for pass so dat dem go partake to helep pipo and medical deliveries as per di coronavirus palava wey dey ground but unfortunately dem come dey use am make money." Di minister tell BBC.

Nigeria bin ban domestic and international flights to stop di spread of coronavirus on May 27, 2020. Dem never announce di actual date commercial flights go resume.

Meanwhile di federal goment though dey work to evacuate Nigerians wey hook for abroad.