Rowan Baxter: How ex-rugby player, im wife and children die inside car fire

Wia dis foto come from, Hannah Baxter / FACEBOOK
One former rugby league player, im wife and dia three children die inside fire for di Australian city of Brisbane.
Emergency workers find di bodi of Rowan Baxter and im pikin dem, wey dey under age of 10, inside car, police tok.
Hannah Baxter, wey be 31 years, die later for hospital from serious burns all ova her bodi.
Report bin say she jump comot from car dey shout : "E pour me petrol".
"Dis na horrific scene," Det Insp Mark Thompson tel tori pipo: "We still dey investigate di mata, but wen police reach di crime scene di car dey burn.
Police find Rowan Baxter, 42, and im three pikin - age three, four and six - wey don die inside di car.
Rowan Baxter bin dey for di front passenger seat and Hannah Baxter bin dey drive di car, police tok.

Wia dis foto come from, ABC NEWS/ LEXY HAMILTON-SMITH
Pipo wey dey live for di area tell Australian tori pipo say dem see madam Baxter, 31, jump comot from di car wen she dey on fire.
End of Di one wey oda users dey read well well
She bin dey critical condition wen dem cari her go Royal Brisbane and Women's Hospital, police tok. But dem confam am say she later die on Wednesday.
Tori be say di couple bin don separate late last year, and dem dey try to agree on who dia children go dey live with.
pair had reportedly separated late last year, and were trying to work out custody arrangements.
Prime Minister Scott Morrison say im "heart dey go out to di families and community wey dey go through dis tragic time and di emergency workers wey dey di horrible scene."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Federal MP Terri Butler say di mata shake am well-well reach bone.











