Why emergency team suspend search for man wey jump from Third Mainland Bridge

Wia dis foto come from, LASEMA
Search and rescue teams for Lagos, Nigeria, don stop di search for di man wey jump enta lagoon from di Third Mainland Bridge on Saturday.
According to di Lagos State Emergency Response Team, LASEMA, di reason why dem suspend di search na sake of di very strong and fast wave of di Lagoon water.
Di divers say, di way di water bin dey move make am hard for dem to fit find di man afta dem don stay too long inside di am.
Dem suspend di search till di Monday.
Tori be say di man bin tell di Uber driver say e wan pee only for am to come down, dive enta di lagoon.
Lagos state police command, say di tin happun around 11 in di morning and all emergency agencies bin dey ground to assist local divers to rescue di man.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin we know about the man
According to Lasema, di man name na Daibo Toju Davies born on 22nd July, 1998.
Dem add say im dey live for number 17 Sosanya Street Gbagada Soluyi Lagos.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Twitter/@rrslagos
According to Lasema, Mr. Davies bin pick Uber from Mercy Hospital, Gbagada before e jump inside di lagoon.
Dem say dia investigation reveal say di victim inform di Uber driver say belle dey pain am. Afta di driver stop, e come jump off di bridge.
Di Agency response team, togeda with di Lagos Fire Service and Marine Rescue team na im bin dey ground to rescue am.












