Akon don get land to build im own city for Senegal

Akon with Senegal officials

Wia dis foto come from, Twitter/Akon

Published
Read am in 1 mins

American- Senegalese musician Akon, dey one step closer to achieve im ogbonge 'Akon City' for Senegal.

Di musician make announcement for social media say im don sign di final agreement with goment for di Akon city.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Akon bin first announce im plans for di "crypto city" for 2018 for di Cannes Lion Festival for France, wen im launch di crypto-currency wey di city go dey use, AKoin.

Im bin tok say e go build di city on top 2,000 acre of land wey di Presido of Senegal, Macky Sall dash am.

Tori be say di city go be five minutes drive from di kontri new international airport.

For interview with Nick Cannon last year, Akon reveal say di construction for di city bin start since March 2019 and di second stage of di city building go happun for 2025.

Dis no go be di only project wey Akon don run for Africa, for 2007, he join hand to form di Konfidence Foundation, wey be health and education charity for pikin dem wey no too get for West Africa and America.

Also, im form di Akon Lighting Africa project for 2014, wey according to Akon website don carry solar power enta 18 African kontris so far.