FUTA don expel six students wey beat up dia fellow student

School building

Wia dis foto come from, futa

Published
Read am in 1 mins

Di Federal University of Technology Akure, FUTA for south west Nigeria don expel six students for bullying of dia fellow student.

Nigerians for social media bin hala no be small afta video show about six students join hand use stick, broom, slaps and blow beat one 100-level female student on November 16, 2019 inside one room wey dey outside di school campus.

Dem beat di girl sotay she land for hospital. But afta some treatment di hospital say she dey okay.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Plenti pipo vex, begin call for di school to expel di students and for police to arrest dem.

Adegbenro Adebanjo wey be di Deputy Director of Corporate Communications for FUTA tell BBC Pidgin say dem expel di students on Tuesday, 26 November afta investigation show say wetin dem do na ogbonge offense and e dey against di University Matriculation Oath.

Di school authorities explain say di expulsion no be because of how pipo para for social media but because di action dey against di rules and regulations of di school.

According to FUTA dis na di names of students wey dem expel:

  • Popoola Olaniyi Agboola 300 Level
  • Oluwadare Faith Tobiloba FST 200 Level
  • Nandi Yohanna Jessica 200 Level
  • Ajuwon Tolani Emmanuella 100 Level
  • Emmanuel Funmilayo Taiwo 100 Level
  • Alao Olabimpe Cecilia 100 Level