Mourinho shine as Tottenham win West Ham for im first match as Spurs coach

Wia dis foto come from, Getty Images
Pipo dey hail di new Tottenham coach Jose Mourinho afta im team waya West Ham 3-2 for Saturday Premier League game.
Di first goal for Spurs come from Son Heung-min wey collect pass from Dele Alli to find di net.
Jose no fit siddon im seat as im jump up dey punch air.

Wia dis foto come from, Getty Images
From dia, tins continue to dey look up for Jose.
Lucas Moura slide in anoda goal for di 43 minutes to make di game 2-1 in favour of di Spurs.
Harry Kane slot in di third goal afta im collect cross from Serge Aurier past di goal keeper Roberto for di 49 minute.
By dis time, Mourinho just dey laugh for di touchline as e be like say tins just dey work brilliantly well for am, to give am im perfect start.
But tins start to dey change from dia, afta Michail Antonio fire one in, afta im receive pass from Mark Noble to make am 3-1.
End of Di one wey oda users dey read well well
Angelo Ogbonna fire in di second goal for di Hammers for di 90+6 minutes to end di game 3-2 in favour of Tottenham.
Jose Mourinho go dey happy with im side, di way di game end but im go also know say im get more work to do, something wey di two late goals im side concede prove.











